How weeks of rain in Kenya don lead to deaths, floods plus affect school resumption

Wia dis foto come from, Getty Images
Rain don dey fall for di past six weeks for Nairobi, and di impact na ogbonge one.
So far, 120 pipo don die, including at least 50 inside di downpour on Monday for area about 60km (37 miles) from Nairobi.
Rivers and soakaways don overflow, roads don become waterways and homes don destroy.
Flooding for Nairobi dey unusual but how big dis year own dey don expose longer term problem wit di way di city don develop.
"You no fit contain nature. e no fit work like dat," Prof Alfred Omenya, one urban planning and environment expert, tell di BBC.
E tok say plenti of di city sit down on top di Nairobi River floodplain, wey cut through di capital. Some oda rivers and streams also dey flow through Nairobi.
Properly developed drainage system fit cope, but as di city don grow ova di last century from 100,000 residents to today 4.5 million, di infrastructure neva keep up.
Compounding di problem na say less dan half of di residents dey connected to one sewage system. For slum areas, open sewers dey common, wey dey overflow wen e flood.
End of Di one wey oda users dey read well well
In di meantime, President William Ruto don tok say pipo wey dey live in dangerous areas around di kontri dem go move to land provided by di National Youth Service, while di goment plan long-term solution.
Im tok say di military and di national goment don dey mobilise to work wit communities.
Neighbouring Kiambu county, part of wey dey ontop di river basin don dey affected by di flood, e also announce say e go take measures to fight di situation, including building inspections.

Wia dis foto come from, EPA
Authorities postpone school reopening

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Kenya ministry of education postpone di reopening of schools across di kontri due to di flooding.
Inside one statement on Monday, Cabinet Secretary of di ministry Ezekiel Machogu say dem go postpone di second term by one week due to di heavy rain, wey don affect some schools in di kontri.
Primary and secondary schools wey suppose open on 29 April go now reopen on Monday, 6 May 2024.
"In di face of di ongoing heavy rains, di Ministry of Education last week don direct im field officers to submit data from all Basic Education Learning Institutions kontri wide to assist di goment in assessing di readiness of di schools for di Second Term opening on Monday, April 29, 2024," di statement tok.
Di ministry tok say dia data reveal say some school don dey affected for different region while di effect of di rain dey severe across di school communities.
Dem explain say dem dey work with relevant agencies to put water-tight measures across di affected schools and also update pipo.
"Reports received at di Ministry of Education, backed up with data from oda relevant government agencies, show say di number of schools in various regions of di kontri don dey affected by di rain."
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Why di school postponement?
Education ministry for Kenya explain say data from Basic Education Learning Institutions show say di heavy rain don severely affect some schools for different regions.
Parents bin raise concerns ova di safety of dia children for school as di second term wan reopen across school in Kenya on Monday, 29 April.
Kenyans don dey suffer road blockages for di kontri since di heavy rain fall, na dis make di goment take di decision on school resumption postponement.
Online fotos show di impact of di flood on schools and houses since di tragedy start.

Wen di school go reopen?
Schools for Kenya go reopen on 6 May 2024 based on di announcement of di kontri ministry of education on Monday.
"Di Ministry of Education don resolved to postpone di reopening of all primary and secondary schools by one week, to Monday, May 6, 2024," Ezekiel Machogu, Cabinet Secretary for ministry of education for Kenya tok.
Although, some parents for di kontri dey complain ova di late postponement wen dem don already make travelling arrangements make dia children resume schools today.
While reacting on X, Nairobi govnor, Sakaja Arthur Johnson tok say goment go provide buses for school children and im go return di fare of stranded school children
"Following di postponement of School Opening Dates and di fact say many parents don already release dia children to report to school dis morning, we don organise di payment of return fare for di stranded students," di govnor tok.
"My teams dey various bus stations sorting out transport for children in uniform as dem dey make dia way back home."

Wia dis foto come from, Kenya National Highways Authority (KeNHA)
How bad Kenya floods dey?
Major roads bin dey flooded, e bin dey cause traffic jams across di kontri.
On Saturday, Kenya Airport Authority issue statement to warn travellers about di heavy rain fall wey don affect di runway, terminals and cargo section.
Di airport authority explain say dem go divert flights.
Kenya National Highways Authority issue advisory to motorists say di heavy rain don wash away several houses for Kinale and Kijabe wey don make di roads impassable for motorists.
"Dis areas dey heavily affected, wit road blockages. Currently, traffic dey stand still around Mai Mahiu centre," di agency tok.
“Authority dey mobilise effort to clear di road and assess damages. Motorists dey advise to expect high traffic congestion around Mai Mahiu. Road users dey expected to plan dia routes accordingly and exercise caution wen travelling through di affected areas.”














