Dubai flood don kill 19 pipo and cause dem to cancel about 300 flights

Wetin we call dis Video, Heavy rain dey cause flash flooding for di UAE city of Dubai

Heavy rains still dey knack Gulf states wey dey cause deadly flash floods and pause flights for di second busiest airport for di world.

Dubai International Airport bin warn say "very challenging conditions" dey ground and advise some passengers make dem no come sake of say some places don turn swimming pool.

For di north, one man die inside im motor as flash floods catch am for dia.

For Oman, rescuers find di deadibodi of one girl for Salem wey bring di number of pipo wey die for di kontri since Sunday to 19.

One Wednesday dem cancel about 300 flights wey dey fly and comot di Dubai International Airport and delay hundreds more, according to Flight Aware data. Dubai International Airport na major hub wey be di break for connecting flights to every continent.

Di airport last year serve ova 80 million passengers wey be only small pass di airport for Alanta US. Dem bin warn say recovery go take time.

On Wednesday, dem advise make pipo no enta Terminal 1 without say dem don confam dia trips wit dia airlines and even make dem no bother to come di airport,.

Emirates, wey be major airline wey get dia headquarters for Dubai bin pause check-in for passengers wey dey comot di city till Thursday.

Authorities warn say more thunderstorms, heavy rain and strong winds still dey come, as many low lying areas still dey under water.

Pipo dey move car wey don hook inside flood water afta heavy rain fall for di Dubai Sports City district of Dubai, United Arab Emirates

Wia dis foto come from, Getty Images

Earlier for statement, di airport say incoming flights wey suppose land on Tuesday evening bin dey diverted "sake of di ogbonge continued weather event wey dey currently happun for di UAE".

E add say departures go continue. Flights bin later start again afta two hours delay.

On Tuesday morning, di UAE National Centre of Meteorology comot wit weather warning for large parts of di kontri wey include Abu Dhabi, Dubai and Sharjah.

Di Gulf region dey very popular as place wey dey hot and dry, even though for recent years, heavy rain wey dey cause flooding don dey more common.

Motor spoil afta one side of di road collapse for di Dubai Sports City district of Dubai sake of heavy rain

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Motor spoil afta one side of di road collapse for di Dubai Sports City district of Dubai sake of heavy rain

For neighbouring Oman, authorities bin say di death toll from flash flooding don increase to 18 and dem still dey find some pipo.

Di number of dead pipo include 10 students wey dey between di age of 10 and 15 wey die on 14 April wen di motor dem bin dey inside bin wan try cross one flooded area, but water carry am go.

For Bahrain, video show cars wey hook for flooded roads.

Motor dey parked for flooded parking lot afta ogbonge rain fall for di Gulf Emirate of Dubai

Wia dis foto come from, Getty Images

Scientists don link di unusual weather to climate change, say ogbonge storms go start to dey more common for future as di planet dey warm dey go.

For evri 1C rise for average temperature, di atmosphere go fit carry around 7% more moisture. Dis fit cause more droplets and heavier rain to fall, and sometimes e go fall in less time and for smaller area.

Di UAE, wey be one of di biggest oil producers for world, bin host di COP28 climate change conference last year.

Driver dey wait as e dey try drive for flooded road for di Dubai Sports City district of Dubai

Wia dis foto come from, Getty Images