Mahamat Deby elected President

Mahamat Deby

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Mahamat Déby dey takeover from im father wey bin rule for 30 years

Military ruler of Chad Mahamat Déby na di official winner of di presidential election wey happun for Chad on Monday.

According to di electoral body wey officially cite provisions of di results declare Gen Déby winner afta im poll 61.3% of di vote while im closest rival, Prime Minister Succes Masra, get 18.53%.

Masra bin declare earlier say im get "resounding victory" for di first round of voting, and say dem bin tiff victory "from di pipo".

Gen Déby, wey dey 40 years, bin sitdown as di leader of Chad by di military afta dem kill im father, Idriss Déby Itno, during one battle wit rebel forces for April 2021.

Im victory mean say di Déby family wey don dey rule since 34 years go kontinu.

Deby promise to be president for all

Afta dem announce di results, supporters of di ruling coalition enta streets of N’Djamena to celebrate Gen Déby victory.

For im victory speech wey dem post on social media, im promised to serve all Chadians - “di ones wey vote for me and president for di pipo wey make oda choices”.

“I get special thought for di unfortunate candidates wey lose di competition.”

Just before dem announce di election results, Prime Minister Masra bin tok say im don win for on live broadcast on Facebook, im call on im supporters and security forces to oppose wetin im tok say na attempt by Gen Déby to "tiff di victory from di pipo".

"A small number of individuals believe say dem fit make pipo believe say dem fit win di election by di same system wey don dey rule Chad for decades," im tok.

"To all Chadians wey vote for change, wey vote for me, I say: mobilise. Do am calmly, wit a spirit of peace," im add.

Demannounce di results of di election wey happun on Monday two weeks earlier dan expected.

Di Constitutional Council still need to confam di results.

women dey pile for voting booth

Wia dis foto come from, BBC/Michel Mvondo

Wetin we call dis foto, Voting don start for Chad to transfer poer back to democratically held goment

Chad don become di first of di kontries wia military seize power for West and Central Africa in recent years to hold elections and go back to civilian rule.

But critics say wit di election of Gen Déby, noting really change.

Di voting on Monday bin dey mostly peaceful but at least one voter die, according to local media.

Some opposition report of irregularities on polling day bin also dey.

Di constitutional council bin remove ten politicians wey bin dey hope to contest sake of“irregularities”, wey some pipo say dey politically motivated.

Gen Déby, Yaya Dillo wey be cousin to Mahamat na anoda potential opponent, wey security forces kill for February wen im bin allegedly lead one attack on di National Security Agency for di capital, N’Djamena.

Activists bin call for a boycott of di election.

Many pipo still dey for exile following a deadly crackdown on opponents wey bin dey protests for October 2022.

Di oil-exporting kontri of almost 18 million piponeva get a free-and-fair transfer of power since dia independence from France in 1960.

Idriss Déby bin overthrow Hissène Habré for1990 and im bin dey in charge for 30 years until im die for battlefield death in April 2021 at di age of 68.

Gen Déby initially pledge to stay as interim leader for just 18 months, a period wey dem bin later extend. Im bin also tok say im no go contest for president.

Profile of Mahamat Idriss Deby

Gen Mahamat for im army fatigues

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Gen Mahamat bin take ova power afta im papa sudden death as dem dey fight rebels for 2021
Who be di candidates wey contest

40 year old Mahamat na di candidate for di United Chad coalition wey claim say dem get ova 200 parties inside.

E dey popularly known as Gen Kaka and e bin turn general for 2010. Until im papa die, e bin dey work as di oga of di presidential guard wey dem call, Directorate-General of di Security Services of State Institutions (DGSSIE).

Mahamat, at first bin promise say e go run 18 month transition to civilian rule as di head of Transitional Military Council (CMT).

Mahamat bin increase im rule by anoda two years wey cause deadly protest wey rights group say kill at least 200 pipo and put ova 1,000 more for prison.

Im campaign platform na wetin im call "12 projects - 100 actions" wia im promise to promote, peace and national reconciliation. E also promise say e no go run "Deby Dynasty".

Succes Masra

Succes Masra on top motor dey campaign

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Succes Masra don deny say e go share power wit di junta if im win

40 year Masra bin dey named as prime Minister for January by Gen Mahamat.

Dis one bin come afta di deal wey di DR Congo President Felix Tshisekedi bin arrange afta di October 2022 protests.

E go run under di Transformers Party wey e bin form for 2018. Di Supreme Court bin no gree am make e run for di 2021 presidential election and e still dey call out di Deby family rule.

Opposition don call out im recent candidacy say e wan run on behalf of Mahamat but e say e no get any plan to share any power wit am.

Im campaign promise wey e tok give France tori pipo for April na say, “I wan be di head of solid state of Chad, a reliable partner wey France fit work wit. And for dis reliable partnership wey I wan develop, some tins go dey for di past century.”

Bifor im join politics, Masra bin work as economist for di African Development Bank (AfDB).

Albert Pahimi Padacke

Albert Pahimi Padacke

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, E bin work as prime minister wit di two Debys

Veteran Politician, Padake go run under di National Rally of Chadian Democrats - Revival (RNDT-Le Reveil) party.

E don contest against Idriss Deby in presidential elections for 2006, 2011, and 2021.

E bin work as prime minister for Deby administration from 2016 to 2018. But e also serve as interim prime minister for Mahamat from April 2021 to October 2021.

Di 57 year old don call out wetin e call friendly match between Mahamat and Masra say dem be “threat to di unity of Chad”.

E bin oppose di new constitution and don promise to “restore democracy” if dem elect am.

Lydie Beassemda

Lydie Beassemda

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Lydie Beassemda bin make history as di first female presidential candidate of Chad for 2021

50 year old Beassemda na di only woman wey dey contest for dis election.

She be di leader of di Party of Democracy and Integral Independence (PDI) since 2018 wen di founder and her papa, Beassemda Djebaret Julien die.

For 2021, she become di first eva female presidential candidate for Chad and come third for polls wit three percent of di votes.

Beassemda don hold ministerial posts from 2018 to 2019 and again from 2021 to 2022.

Her campaign proposals include to create federal state and also to modernise agriculture and strengthen di kontri education system.