Video show biggest Taiwan earthquake in 25 years dey destroy houses

Wetin we call dis Video, Watch moment 7.4 magnitude earthquake hits Taiwan
Video show biggest Taiwan earthquake in 25 years dey destroy houses

Eyewitness video show extensive damage for Hualien, near di quake epicentre, and some buildings lean at 45 degree angle.

Di tremors wey happun on Wednesday, 03 April, also trigger landslides, and put nearby villages in dust.

Rescue efforts dey go on and dem don confirm say four pipo don die.

Di earthquake na di strongest wey dem record for Taiwan for 25 years.