Video show moment earthquake hit Japan coastal town

Wetin we call dis Video, WATCH: Moment wey earthquake hit Japanese coastline for Ishikawa prefecture

Japan don issued one major tsunami warning afta a 7.6 magnitude earthquake strike di central region.

One series of earthquakes also strike nearby areas, wit residents for several coastal prefectures tell to evacuate.

Footage from Japanese broadcaster NHK show di moment one earthquake shake Suzu, on di coastline for Ishikawa prefecture.

Only today dem don report around 60 earthquakes for Japan, and e happun over di past few hours, earthquakes still dey continue for central Japan.

Japan earthquake

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Huge cracks open for ground for Wajima city, also for Ishikawa prefecture, afta di earthquake

Na about 60 don happun since 4:O.clock local time (07:00GMT), wen di 7.6 magnitude quake hit di Noto region.

Di quakes wey follow dis particular earthquake get different magnitudes wey range from 3 to 6.1.

Di most recent one, wey dem record happun around 23:02 local time (14:03 GMT) .

Dem bin initially report am say e dey on di same scale wit di initial earthquake wey happun for Noto dis morning, but now dem don record am as magnitude 4.6.

Japan's meteorological agency bin don warn pipo about possible serious earthquakes ova di next week, especially ova di next two to three days.

Although di "major tsunami warning" don dey downgraded now to "tsunami warning", and dem still advise residents to comot from those areas as dem still dey record tsunamis.

One of di videos of di earthquake show how pesin wey dey inside car capture significant damage for Uchinada, Ishikawa prefecture.

Di road surface of a car park tear and crack as di passenger films out of dia open window.

Di arge earthquake wey happun just off di Noto Peninsula around a little afta 4pm local time dey very shallow and e cause serious shaking wey bring down buildings for towns and villages along di coast.

For many hours afta di quake happun authorities say di Sea of Japan coast fit dey hit by tsunamis of up to five metres.

Dem bin tell tens of thousands of pipo were to comot from dia homes and go wia di ground dey higher.

Earthquake for Japan

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Parts of one structure don collapse for di Onohiyoshi Shrine for Kanazawa

E immediately bring back memories of March 2011 wen one15m tsunami cause massive destruction along Japan north-east coast, wey kill more dan 18,000 pipo.

Old houses fall down, roads tear up, bridges and railways get serious damage.

Tori be say some pipo dey trapped under collapsed buildings and hospitals dey report say many pipo wound.

'Di whole room bin dey shake'

One snowboarder wey dey on holiday for Japan's Hakuba Alps bin dey for im hotel room wen di earthquake strike.

"Di whole room bin dey shake, di TV bin dey shake, I get to keep evritin ontop di able," Baldwin Chia tell Reuters news agency.

"My friends bin still dey outside," Chia tok. "So my first instinct na to text dem, to see if dem dey okay."

Im say im bin dey concerned about avalanches but im bin neva receive any reports of any taking place.

Chia say even though im bin feel safe for di room, evritin around am bin dey shake.

"Wen you hear about earthquakes for Japan," im continue to tok "you no go expect say you go actually experience one," im describe di earthquake as " wetin big well well"

Fire department receive 30 reports of collapsed buildings.

Di Wajima City Fire Department for Ishikawa say dem don receive at least 30 reports of buildings wey collapse, na wetin di Japanese public broadcaster NHK dey report.

Pipo tap under di rubble of collapsed houses, according to goment tok-tok pesin

Yoshimasa Hayashi, chief cabinet secretary of Japan, dey give news conference, where e warn of di risk of further earthquakes.

E tok say di authorities still dey collect information on di damage. Dem neva tok about overall casualties.

However, di goment tok-tok pesin say dem get six reported cases of pipo wey trap under di rubble of collapsed houses.

Im no fit tok if dis one mean say na six pipo or more, but e tok say dem don get multiple reports of buildings wey dey fall down.

One pesin die afta earthquake - report

Japanese broadcaster NTV don report say one pesin don die afta one building collapse for Shika town, for di Ishikawa prefecture.

Separately, two pipo for Nanao City for di same prefecture suffer cardiac arrest, Japan National Police Agency tok.

At di moment, we know sabi di condition wey dose two pipo dey.