Pope Francis don dey discharged from Rome hospital - video capture im first public appearance as e greet cheering crowd

Wetin we call dis Video,
    • Author, Bethany Bell
    • Role, BBC News
    • Reporting from, Rome
    • Author, Zahra Fatima
    • Role, BBC News
    • Reporting from, London
  • Read am in 3 mins

Pope Francis on Sunday 23 March show face for di window of di hospital for Rome for di first time since dem admit am on 14 February.

Dem discharge am minutes later from Gemelli hospital and doctors say im go need at least two months of rest at di Vatican.

Di 88-year-old bin dey admitted to di hospital on 14 February wit a severe respiratory infection wey bin result in double pneumonia.

During di past five weeks, im bin present "two veri critical episodes" wia im "life bin dey in danger", Dr Sergio Alfieri, one of di doctors wey dey treat di Pope, tok.

Dem bin no intubate Pope Francis and e always remain alert and oriented, Dr Alfieri tok. Di Pope neva dey completely healed, but e no get pneumonia again and e now dey stable condition, according to im doctors.

Pope Francis

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Pope Francis (file image) don dey battle double pneumonia for more dan five weeks

"Today we dey happy to tok say tomorrow e go dey home," Dr Alfieri tell reporters on Saturday.

Di Pope go offer a blessing from im window at di Gemelli hospital on Sunday - di first time e go appear in public since e dey admitted to hospital - bifor e return to im residence at di Vatican.

Dr Alfieri say patients wit double pneumonia lose dia voice a little and "especially di old pipo, e go take time for your voice to return to normal".

On Friday, Cardinal Victor Fernandez say "high-flow oxygen dry evritin out" and as a result di Pope "need to relearn how to speak", Reuters bin report.

Doctors say if di trend of improvement continue, di Pope go fit return to work as soon as possible.

Di Vatican bin tok on Friday say di Pope don see some improvements for im breathing and mobility.

Dem confam say di Pope no longer use mechanical ventilation to dey breathe for night, but instead im dey receive oxygen through a small tube under im nose. During di day, im dey use less high-flow oxygen.

Di public don only see di Pope once since im dey admitted to di hospital, in a photograph wey di Vatican bin release last week, wey show am as e dey pray inside one hospital chapel.

Earlier dis month, dem play one audio recording of Pope Francis for St Peter's Square for Vatican City - na im native Spanish im take speak for dat audio.

Im voice bin dey breathless as im thank di Catholic faithful for dia prayers.

Pope Francis don spend 12 years as leader of di Roman Catholic Church.

Di Pope don suffer some health issues throughout im life, including having part of one of im lungs removed at di age of 21, and dis make am more prone to infections.