In pictures: How pipo dey pray for Pope Francis around di world
Wia dis foto come from, Reuters
Wetin we call dis foto, Nuns dey pray as Pope Francis continue im treatment for Gemelli Hospital, for Santa Maria Addolorata, for Rome, Italy, on 25 February, 2025
Read am in 5 mins
Pope Francis still dey critical condition, na wetin Vatican tok as dem give update on im health, dem say im get respiratory and kidney problems.
Around di world, prayers and services bin take place in support of di pontiff.
For Vatican, pipo gada for St. Peter's Square.
Wia dis foto come from, Reuters
Wetin we call dis foto, Pipo carry one cross for St. Peter's Square, for di Vatican, on 26 February 2025
Wia dis foto come from, Reuters
Wetin we call dis foto, One pesin hold Pope Francis photo for St. Peter's Square, for Vatican, on 26 February 2025
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Priests attend one rosary prayer for Pope Francis for St. Peter's Square for Vatican, on 24 February 2025.
Wia dis foto come from, AFP
Wetin we call dis foto, One priest hold rosary for St Peter's basilica bifor prayers for di health of Pope Francis for Vatican on 24 February 2025.
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Pipo attend Vatican State Secretary Pietro Parolin Rosary prayers for St. Peter's Square on February 24, 2025 for Vatican City, Vatican
For Rome, dem leave flowers and tributes outside di Gemelli Polyclinic, wia dem dey treat di Pope.
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Pipo pray in front of di statue of Pope John Paul II outside Rome Gemelli Polyclinic, wia dem admit Pope Francis for hospital.
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Pipo dey pray in front of di statue of Pope John Paul II for outside Rome Gemelli Polyclinic, wia Pope Francis hospital dey
Wia dis foto come from, AFP
Wetin we call dis foto, Nuns dey pray in front of di statue of Pope John Paul II outside Rome's Gemelli Polyclinic, wia dem hospitalize Pope Francis on 24 February 2025.
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Tributes of flowers, images, candles, and drawings under di statue of Pope John Paul II outside Gemelli Polyclinic for Rome, wia dem admit Pope Francis for hospital.
Di Archbishop of di City of Buenos Aires, Jorge Garcia Cuerva, lead mass for Pope health.
Na dis city dem born Pope Francis and im be Archbishop dia for1998.
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Di archbishop of di City of Buenos Aires Jorge Garcia Cuerva lead mass for Pope health for Buenos Aires, Argentina on 24 February 2025.
Wia dis foto come from, AFP
Wetin we call dis foto, One man hold portrait of Pope Francis for mass for im healing for Constitution Square, Buenos Aires, Argentina, on 24 February 2025.
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, One woman hold a sign for mass for di healing of Pope Francis for Constitution Square, Buenos Aires, Argentina, on 24 February 2025.
Pipo pray for Guatemala City.
Wia dis foto come from, AFP
Wetin we call dis foto, Pipo dey pray during one mass for di health of Pope Francis for di Metropolitan Cathedral for Guatemala City on 23 February 2025.
One woman cry during one mass in honor of Venezuelan Jose Gregorio Hernandez, wey many know as di "Doctor of di Poor," afta Pope Francis approve im canonisation, for Caracas, Venezuela.
Wia dis foto come from, Reuters
Wetin we call dis foto, One woman react during one mass in honor of Venezuelan Jose Gregorio Hernandez, wey many know as di "Doctor of di Poor," afta Pope Francis approve im canonisation, on 25 February 2025.
And for Mumbai, India, one artist make im own colourful dedication.
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, One man paint poster of Pope Francis for Mumbai, India, on 24 February 2025.