Death toll for Benue herdsmen attack on Logo and Gbagir rise to 56

Benue state govnor, Rev Fr Hyacinth Alia

Wia dis foto come from, Benue State Government

Read am in 3 mins

Di number of pipo wey don die don reach 56 for Logo and Gbagir communities for Ukum local goment for Benue State, north central Nigeria, afta one coordinated attack by suspected herdsmen.

Di Nigeria Police Force, Benue Command, say di attack happun on Thursday night around 9pm.

For statement wey di Benue Police tok tok pesin, CSP Anene Sewuese Catherine bin sign, she say during shoot out wit di gunmen to chase dem comot, na im di attackers begin shoot anyhow, killing unsuspected farmers wey dem see dey waka for road.

Anene add say, police no know say as dem dey try pursue di suspected herdsmen, anoda attack bin dey happun at di same time for Logo.

"Unfortunately one simultaneous attack wey we bin no suspect bin dey happun for Logo wia dem kill twelve pipo before police arrive," Anene tok.

Earlier inside one TV broadcast wey di state govnor, Rev Fr Hyacinth Alia bin don shortly afta di attack, im say: "we don confam di tragic loss of twenty (20) precious lives for Sankera axis.

"Dem bin first recover five deadi bodi for Gbagir, carry go mortuary. Later area pipo wey bin dey search for dia loved ones find two more."

"At di same time, police recover twelve more deadi bodi, to make am di total number of lives lost to twenty.

Di govnor lament say all dis deadi bod idem no be just numbers, but dem be pio "papa, mama, pikin dem, brothers and sisters."

Dis two attacks na di most recent one wey dey happun inside two weeks since di Nigeria President Bola Tinubu, go France, den enta London for working visit.

Within dis period, before dis new attacks, more dan 150 pipo don die for suspected herdsmen and bandit attacks for Plateau, Kebbi, Katsina states and dis same Benue state.

Di high rate of killings inside dis two weeks don make many important Nigerians tell di president make im cut im travel and return home to come attend to the security concerns.

In response, di Nigeria presidency say Tinubu don give instructions to im security chiefs on wetin o do, even as im dey obodo Oyibo.

Wit dis recent attacks for di Sankera axis, pipo dey wonder about di absence of di head of di kontri.

President Bola Tinubu go return on Monday, according to statement from di Presidency.