Jaguda pipo kill dozens of villagers for inside anoda attack for Plateau State

Wia dis foto come from, Red Cross
Anoda attack don kpai plenty pipo for Bassa local goment area of Plateau State, north-central Nigeria, according to wetin residents tell BBC Pidgin.
Dis fresh attack happun for di early hours of Monday, between 1am and 2am.
Yakubu Ventim who be tori pesin for di state tok say di chairman of Bassa local goment area, Joshua Sunday Riti, bin carry some TV tori pipo wit plenty security to di community wia di attack bin happun.
"Na about 38 to 50 pipo dey massacred for di village dis morning.
"Dem ambush di community and kill mostly women and children," oga Ventim tok.
"Security don dey drafted to di area but we no know how tins be now. Di security pipo neva address tori pipo about dis particular attack."
Channels TV also report di attack wia dem tok say na 36 pipo bin die afta di jaguda pipo shoot dem, but anoda four later die for hospital to make am a total of 40 pipo wey kpai for di attack.
Wakili Tongwe, wey be community leader and also one of di vigilante pipo wey bin dey on duty wen di attackers come na im confam di attack.
End of Di one wey oda users dey read well well
BBC Pidgin call di police tok-tok pesin for Plateau State, Alfred Alabo, to get details but e no answer im call and e neva respond to message wey we send to am.

Wia dis foto come from, Nigeria Army
About two weeks ago, 52 pipo bin kpai for inside anoda attack for Bokkos local goment area of di same Plateau State.
Di development make di National Security Adviser (NSA) Nuhu Ribadu to visit di area and tok say enough don dey enough for di killers, and e go make sure say di killings stop.
Ova di years, crisis between herders and farmers na regular tin for many parts of northern Nigeria including Plateau and Benue states.
But recently, di govnor of Plateau State, Caleb Mutfwang, tok say dis regular attacks wey dey happun for di state don pass herdsmen and farmers fight and add say wetin dey happun now na terrorist attacks and "genocide".
Mutfwang tok dis one for one interview wit tori pipo as e lament say di killings don too much despite all di efforts wey di state goment dey do to make sure say peace dey.
"I dey tell you for all honesty say I no fit find any explanation wey pass say dis na genocide wey terrorists dey sponsor. Di question na who be di pipo wey dey behind di organisers of dis terrorism? Dis na wetin di security agencies gatz help us to reveal," di govnor tok
"As I dey tok to you, e no dey less dan 64 communities wey don dey taken ova by bandits for Plateau between Bokkos, Barkin Ladi, and Riyom local goments. Dem don take di communities ova, rename dem, and pipo dey live dia comfortably on top lands wey dem pursue pipo comot and occupy."
For December 2023, jaguda pipo kpai more dan 115 pipo and displace 64 communities for Bokkos and Barkin-Ladi local goment areas of Plateau State.














