How ova 115 pipo die for Plateau attacks, 64 communities displaced

Plateau attack

Wia dis foto come from, Channels TV

Govnor of Plateau State, Caleb Mutfwang say di kasala wey dey happun for Plateau dey increase sake of say security pipo neva arrest anybodi so far.

Govnor Mutfwang tok for interview wit local tori pipo Channels TV on Tuesday 26 December, 2023 afta gunmen attack some communities.

Govnor Mutfwang wey dey mourn describe di attack as “unprovoked” afta jaguda pipo attack more dan 15 communities for Bokkos and Barkin-Ladi Local Goment Areas of di state.

Tori be say more dan 115 pipo don die from di attacks and plenti odas wound. Dem also burn hundreds of houses.

Govnor Mutfwang say: “We must stop dis carnage, we no go continue wit dis reactionary strategy but be proactive”.

Im add say for Barkin-Ladi Local Goment Area, terrorists na dem dey occupy schools for some years now.

Im explain say not less dan 64 communities dey displaced already and and di terrorists don take over di lands.

Im say: “I go tok to Mr President on dis. We need to summon di political will to give instructions to security agencies to protect di territorial integrity of Nigeria and even di internal integrity of our land boundaries.”

Plateau attack

Wia dis foto come from, Channels TV

Wetin we call dis foto, Di attackers bin burn plenti houses, steal from farms and destroy plenti properties

Wetin really happun

Monday Kasa, wey be di transition implementation committee chairman of Bokkos Local Goment area, tell tori pipo say di attack happun on Saturday till Sunday morning wen residents bin don dey for festive mood.

Di chairman tok say deadi bodi dey increase as security officials, hunters and vigilante group dey look bush to find pipo wey dey miss for di communities.

Oga Kasa say di gunman set pipo houses on fire, damage dia tins and still come steal dia farm harvests.

Earlier, Govnor Mutfwang inside statement by im tok-tok pesin Gyang Bere bin don direct security agencies for di state to begin arrest di gunmen wey dey responsible for di crime and ensure say dem face di law.

Di govnor also ask members of di communities make dem dey vigilant and report any criminal activities to security officials.

Di govnor also wish di pipo wey wound quick recovery while im sympathise wit di pipo wey dia relatives die for di attack.

“Govnor assure say proactive measures go dey available to reduce di ongoing attacks on innocent citizens.

"E sympathise wit victims families as im dey beg dem make dem find solace in God as di goment dey work to end di violence,” di statement tok.

Bere tok say as di state dey faces dis challenges, Govnor Mutfwang extend im prayers for peaceful Christmas celebration for Plateau and across di kontri.

Police tok-tok pesin Alabo Alfred say once dem make any arrest dem go inform tori pipo.

Attacks for Plateau State

Dis no be di first time dis kain kasala dey happun for Plateu state, north central, Nigeria.

And na jaguda pipo dey enta communities go attack pipo most of di time.

One young lady lose her three brodas for di massacre wey kill at least 150 pipo.

Di attack happun for communities for di villages for Mangu LGA.

According to di National President, Mwaghavul Development Association, Joseph Gwankat, di pipo wey die reach 85 and search bin still dey go on. But police confam say more dan 30 pipo die for di incident

Di Plateau State Police Command confam say na 30 pipo die for di attacks on di affected villages.

DSP Alabo Alfred, tok-tok pesin for di state command say "so far over 30 pipo na im we don confam dead including women and children.”

CAN condemn attacks

Di Christian Association Of Nigeria (CAN) don condemn di Christmas Eve attack wey happun for some communities for Bokkos and Barkin-Ladi Local Government Areas of Plateau State.

Di president of CAN, Daniel Okoh inside one signed statement say di attack on di community na threat to di kontri peace, unity and mutual respect.

Oga Okoh wey double as archbishop say di church stand wit di victims families and friends as dem dey grief dia loss.

“We condemn dis acts of violence in di strongest possible terms. Di burning down of houses, and worship centres, and di destruction of properties worth millions of naira no be only criminal act but also direct assault on our shared values of peace, unity, and mutual respect,” di statement tok.

“We dey mourn wit di families, friends, and communities wey tragically lose dia loved ones for di villages of Ruku, Hurum, Darwat, Mai Yanga Sabo, NTV, and Lisham Kwahasnat community for Wase LGA.

“We stand wit you at dis time of grief, and our prayer go out to you for comfort and strength. Di loss of lives, including dose of our brethren for di Baptist Church for Chirang village, na devastating blow to our collective peace and unity.”

Di archbishop commend di effort of di state security officials and di state govnor of Plateau, Caleb Mutfwang for dia proactive measure to find di gunmen while im dey demand for peace and preventive measure wey go help curtain di attacks.