One family lose 12 pipo, anoda lose 11 – Eyewitness tok of di horror for Kaduna army bombing

Some pipo wey witness the bombing incident for Tudun Birni village for Kaduna state, don tell BBC di horror wey dia eye see for dat Sunday night.
Dem tok how pipo body parts take scatter all over di place after di bombing, wey di Kaduna State Government tok say na Nigeria Army throw am by mistake for village.
“Di tin happen around 11pm for night. Pipo call me for phone but e don late already. Na around 9 in di morning I go di village,” one woman wey give her name as Aisha tok.
Aisha tok say she see as dem dey sort dead bodies, many of dem don pieces and dem wrap dem for sacks.
“I dey dia as e dey happen and I get record for my phone,” she tok.
“Some of di deadi body dey hang for tree and rooftops. No security pesin dey dia at dat time, na only relatives and KADVIS (Kaduna Vigilante Service) pipo.
“Dem drop two bombs for thirty minutes interval. Di second bomb affect pipo wey go carry di dead body of pipo wey die for di first blast.
“One family lose 12 pio, anoda family lose 11 pipo. Some women carry dia pikin for hand die, some pikin survive but oda die wit dia mama.”
Aisha tok say e get families wey be say na only one or two persons survive.
Anoda witness wey im name na Idris tok say dem dey hold Maulud anniversary “at least 15 times evri year”.
E tok say about 34 pipo for him family die for the incident, and about 66 pipo for di community still dey receive treatment for Barau Dikko Hospital.
“I dey call on goment to pay compensation make justice dey,” Idris tok.
Bombing Incident dey painful – President Tinubu

Wia dis foto come from, Nigerian Govt
Meanwhile, President Bola Ahmed Tinubu don sympathize wit families wey lose dia loved ones for di bombing incident in Tudun Birni, Kaduna State.
For inside one statement signed by im Special Adviser on Media and Publicity, Ajuri Ngelale, Tinubu tok say di incident dey “very unfortunate, disturbing, and painful”.
President Tinubu beg pipo make dem calm down as relevant authorities don begin to investigate di matter.

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Kaduna state goment tok say na Nigerian Army carry out di air strike for Tudun Biri village.
For statement, Samuel Aruwan wey be commissioner wey dey oversee ministry of internal affairs for Kaduna tok say Nigerian army don siddon wit deputy govnor Hadiza Balarabe to yarn say ‘na mistake’.
Di statement add say Major V.U Okoro wey be General Officer Commanding One Division tok say dem bin dey on a mission against some terrorists wen dem mistakenly bomb civilians.
Di Nigerian Air Force (NAF) bin earlier deny informate say dem get hand for one bombing wey kill many villagers for Tudun Biri village for Igabi Local Government Area of Kaduna State.
NAF Air Commodore Director of Public Relations and Information, Edward Gabkwet for one statement clear di air say dem no carry out any air operations within Kaduna state and environs in di last 24 hours.
E also note say NAF no be di only organization wey dey operate combat armed drones for di North western region of Nigeria.
Di statement add say e dey important make tori pipo confam tori before dem go press wit unverified and unconfirmed reports.
Videos wey dey circulate for social media show plenty deadi body wey spread for ground.
Aruwan say search still dey go on for some of di victims but dem don move majority of dem to Barau Dikko Teaching hospital inside Kaduna city for treatment.










