Wetin dey happun for Wad Madani for Sudan?

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Mohamed Osman and Amal Saeed
- Role, BBC News Arabic
For morning of 15 December, more dan one dozen troops for military vehicles attack Wad Madani, Sudan second most populous city afta di capital, Khartoum. Di troops belong to di Armed Support Forces (RSF), di paramilitary group wey don dey fight di Sudanese army since April.
Three days later, di RSF bin announce say dem don take control of Wad Madani. Di fighting don displace more dan 300,000 pipo, according to di UN International Organisation for Migration (IMO). Many of dem run from clashes for di Khartoum region only months earlier.
Why Wad Madani dey important for Sudan warring parties?
Na strategic city

Wia dis foto come from, Getty Images
Wad Madani city, di regional capital of Al-Jazira state, dey for 175 km northeast of Khartoum. Home to 700,000 pipo, e dey also host more dan 86,000 pipo wey di ongoing conflict between di Sudanese armed forces and di RSF displace.
Di city na home to di Sudanese army First Infantry Division, wey make di taking of Wad Madani a huge victory for di RSF.
Al-Jazira border three main states wey di army dey control - di White Nile, Senar, and Gadaref.
"Dis one give di RSF chance to take dose states as well," Abdullah Mohamed Ahmed tok - na Sudanese retired general and military expert.
"Di military sites and ammunition di RSF don seize for Wad Madani go serve as new locations for recruitment and training. And as jump off point to new destinations."
End of Di one wey oda users dey read well well
Also, Wad Madani na home to di region main health facilities, including Sudan largest cancer treatment unit. Di city previously serve as hub for di many aid agencies wey dey run from Khartoum afta di war bin start eight months ago.
But since di taking ova of Wad Madani, dem also gatz leave, move out to various nearby cities.
New wave of displacement

Wia dis foto come from, Getty Images
According to di UN, for di past week more dan 300,000 pipo don run from Wad Madani and di surrounding areas.
Khadeja, one mama of five, run from di fighting for Khartoum only seven months ago. Tins don finally start to feel calmer for her and her family, all up until last week.
Wen di fighting break out for Wad Madani, she sabi say she gatz move again.
"I take my kids and get inside one local minibus to reach di nearest bus station,” she tok.
“From dia, we take anoda vehicle to get out of di city. I give di driver di last penny wey I bin get."
Khadeja tok say she see hundreds of families wey dey leave on foot, dem carry all di loads wey dem fit carry.
Afta dem reach di city of Sanar, approximately 100km south of Wad Madani, Khadeja tok say di conditions dem dey face now dey even worse dan di ones for Wad Madani.
"We dey stay for one school for di city suburbs. Food or water no dey. We gatz sleep on di ground," she tok.
"At least for di shelter for Wad Madani, we bin get meals and medical care.”
The people who stayed

Wia dis foto come from, Getty Images
What about pipo wey don choose to stay for Wad Madani?
Abd-Elhamid (no be im real name), one college professor wey dey live for di north of di city, tell di BBC im refuse to leave im home behind.
"I grow up for Wad Madani and I no go leave. No mata how dangerous e become," e tok.
Abd-Elhamid e get troubling moments afta di arrival of RSF forces for im neighbourhood.
Di professor claim say di troops now dey "evriwia" for Wad Madani, afta dem build checkpoints across di main streets and around all goment facilities.
"Some of dia fighters don start to loot from di cars and houses pipo bin leave behind," Abd-Elhamid tok.
E also claim say di RSF fighters don arrest dose wey dem believe say na supporters of Sudan former President, Omar al Bashir. One military coup for 2019 na im depose Bashir.
“Di shops don dey closed, hospitals don dey out of service and presence of di army or di police no dey. Only di RSF fighters dey here," Abd-Elhamid tok.
"Wad Madani na ghost town."
What's the current state of the conflict?

Wia dis foto come from, Getty Images
Since di hostilities break out for April, Sudanese army or di RSF neva achieve ogbonge victory on di ground.
Di RSF control nearly 70% of di capital, Khartoum, as well as four states out of five for Darfur, and most recently, di city of Wad Madani.
While di army dominate di north and east of di kontri and nearly 30% of di capital.
Saudi Arabia, di African Union, and di US don put several political attempts to negotiate a permanent ceasefire on di table during di past 8 months - but anyone neva succeed.














