Dem kill my father-in-law and im four brothers - survivor of Plateau attack

Deborah Samuel na one of di survivors of di attack for Plateau communities wia dem kill some pipo including women and children.
Na on Tuesday, residents wake up to di distressing news of di overnight attack on of Kubat Village for Mangu Local Government
Deborah tell BBC Pidgin say she lose her father-in-law and four younger brothers to her husband.
"E no dey easy for us on di day of di attack. We bin dey di market wen suddenly we begin dey hear gunshots from different angles. We begin run.

Reverend Jesse Joshua Jwanle, of Assembly of God Church for Gaude village of Mangu Local Government Area of Plateau State na also one of di survivor of di Tuesday attack wey claim many lives including women and children.
While im dey narrate how di attackers invade im community, Reverend Jwanle tell BBC News Pidgin say im escape di attack “just by di will of God.
“Di attackers come from di west of the community in dia numbers. Dem come in groups. As dm dey near di community, dem begin dey shoot and almost everybody begin run.
Dem kill some and some manage to escape.”, e tok
End of Di one wey oda users dey read well well
E add am say dem burn im house “dem burn all my properties for di house except di clothes on me. I lost a lot for di house.
Dem burnt all di Assembly of God Churches. I also lose one of my Church member.
Reverend Jwanle don run go neighbouring Halle town for cover.

Wia dis foto come from, Red cross
Death toll reach 85 - community leader
Di death toll for Tuesday attack on communities for di villages of Mangu LGA don rise to 85 as di search for missing pesin still dey go on, Di National President, Mwaghavul Development Association, Joseph Gwankat, tok am wen im dey follow journalists tok on Wednesday afta one security meeting for di palace of di traditional ruler for Mangu.
Gwankat also tok say di suspected herdsmen attack plenty communities at di same time. kill, as well as burn houses and destroy farmlands.
Women wey dey protest don enta di palace of di traditional ruler wia dem set up security meeting wit security chiefs, district heads and govment officials wey Deputy Governor, Professor Sonni Tyoden lead, to address di security challenge for di LGA.
Police confam ova 30 pipo die for di incident
Di Plateau State Command on Thursday confam say na 30 pipo die for di attacks on di affected villages.
DSP Alabo Alfred, tok-tok pesin for di state command say "so far over 30 pipo na im we don confam dead including women and children.”
Lalong order security to find di gunmen

Wia dis foto come from, Plateau State Government Press
Plateau State Governor Simon Bako Lalong don order security forces to gbab di attackers.
Govnor Lalong say im dey seriously disturbed about di sad development wey make am immediately direct security forces to pursue di attackers and make sure dem arrest dem.
Im describe di attack as anodas attempt by crises merchants and criminals to return di State to di dark days of pain and agony.
“Govment go stop at nothing to make sure say we deal mercilessly wit those wey dey behind dis scheme”, e tok.
Similar attack happun for Kanam local goment area of Plateau state for April 2022 wey leave at least 150 pipo dead and pipo miss.
One of di survivor, Zainab Kukawa tell BBC News Pidgin say di whole thing start around 11:07am one Sunday morning.

Wia dis foto come from, Red cross
Zainab say di attackers work for three hours wit no security help.
'I use my eyes see di attackers as dem come on top bikes.
Dem spend up to three hours unchallenged.'
She believe say bicos of di way di attackers dey free to do tins, e lead to many deaths.
Sake of dat attack authorities say dem deploy more security forces to di area.
Nigeria dey struggle wit a wave of violence by armed gangs wey don frequently carry out killings and kidnappings for ransom – mostly for unprotected rural communities.















