Imam wey save Christians wen e hide dem for mosque during herdsmen attack for Jos don die

Head and shoulders foto of Imam Abubakar Abdullahi as e dey look side during one interview

Wia dis foto come from, US Embassy Nigeria

Read am in 3 mins

Abubakar Abdullahi one renowned Imam for Nigeria for Nghar village, Plateau State, wey bin save hundreds of pipo inside mosque wen dem run from killer herdsmen don die at di age of 92.

Imam Abubakar Abdullahi gain local and international recognition for im bravery for June 2018.

Wen di clash hapun for Barkin Ladi local govment for Jos, Plateau state, e hide ova 262 Christians inside im mosque and im house, to protect dem from killer herdsmen wey wan attack dem.

For 2019, di U.S. State Department honour am wit di International Religious Freedom Award for im "selfless commitment to religious freedom"

For 2022, di Nigerian govment also award am wit national honour.

Imam Abdullahi die on Thursday night for Plateau Specialist Hospital in Jos afta im get heart problem .

Di family of di cleric don bury am on Friday for Nghar village afta Juma'at prayers.

Di Plateau State Government, inside one statement wey di tok-tok pesin to di govnor, Gyang Bere issue on Friday, say di state govment mourn di passing of di late cleric.

Govnor Caleb Mutfwang tok say Imam Abdullahi na man of purpose, wey dey committed to peace, unity and di protection of di vulnerable especially women and children.

According to di statement, di govnor tok say im death na loss to im family, community and state while im commend di cleric for building interfaith harmony, compassion, forgiveness and empathy among di communities in di states.

Govnor Mutfwang tok say di passing of imam Abdullahi hapun wen di state need guidance, wisdom and how e dey bring pipo togeda.

"E urge di immediate family and di entire community make dem find comfort in di knowing say di late Imam live life of faith, compassion, and fairness. e live behind betta legacy of service and peace," di statement tok.

Also, former vice-president of Nigeria Atiku Abubakar mourn di passing of imam Abubakar Abdullahi as im praise am for being patriotic during di June 2018 Plateau crisis wia im open im mosque and house to "protect ova 260 Christians, even though na great personal risk."

Atiku ontop im X page on Friday urge pipo make dem commit to di ideas wey di cleric show wen e bin dey alive. "as we grieve im passing, make we recommit to di ideals wey e embody in inter-faith harmony, mutual respect, and unwavering defence of di sanctity of every human life."

Also, former senator wey represent Kaduna central, Shehu Sani ontop im X account tok say, imam Abdullahi na peacemaker and iconic symbol of tolerance and courage.

Abubakar don raise di bar for compassion and coexistence for community wey dey fight. Make im soul rest in perfect peace," e tok

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post