‘Impeachment na di only way to go’ - Rivers Assembly alert Chief Judge to investigate Fubara

Rivers State govnor Siminalayi Fubara

Wia dis foto come from, Siminalayi Fubara /Facebook

Read am in 6 mins

Di Rivers State House of Assembly say dem go continue wit di impeachment of Govnor Siminialayi Fubara and im Deputy, Prof Ngozo Nma Odu.

Dem tok dis one wen di House resume sitting for di Conference Hall of di Assembly Quarters wia dem dey temporarily seat for Port Harcourt.

Majority leader and member representing Akuku Toru state constituency I, Major Jack explain say dem dey continue becos di Rivers Govnor and Deputy continue to disregard di constitution and no regard dem at all and feel say e fit do anytin wey e like despite di intervention of di President.

E say since dem serve dem wit di impeachment notice, dem never make any effort to respond and so e call in di Sleaker say make dem continue wit di impeachment proceedings.

Even di four lawmakers wey bin make statements to appeal to dia colleagues not to continue wit di impeachment also don withdraw dia plea and say dem dey in support for di impeachment.

Di Deputy Minority Leader and member wey dey represent Omuma state constituency, Sylvanus Nwankwo say even after dia plea, di Govnor through im media aides dey incite di pipo against dem and dey disregard di constitution and so sake of dat impeachment na di way to go.

Dem maintain sat impeachment dry constitutional amd na di right tin dem dey do so make pipo for di State support dem.

Di House adjourn sitting to Tuesday 20 January for di continuation of di impeachment proceedings.

Di impeachment move against govnor Siminalayi Fubara and im deputy, Prof Ngozi Odu, bin suffer some setback wen four lawmakers withdraw dia support to di process.l and appeal for a peaceful resolution to di crises.

Barile Nwakoh of Khana Constituency I and Emilia Amadi of Obio/Akpor Constituency II say dem for favour a peaceful resolution of di political crisis instead of going ahead with di impeachment.

For one media briefing dem do, Nwakoh wey be di Deputy Minority leader for di house say although dem acknowledge di alleged constitutional breaches wey di Assembly accuse Govnor Fubara, wey make dem wan impeach am, but appeals from elder, leaders and stakeholders from dia constituency na im make dem decide to step back in di interest of peace and stability.

“As we carefully consider dis appeals, we hereby express our willingness to consider a political solution rather than di outright removal of di Govnor and Deputy Govnor. We respectfully call on our oda colleagues for di Rivers State House of Assembly to also consider dis path.

"Dis position no come out of weakness. Rather, na sake of our conviction as leaders with forgiving hearts and, importantly, as mothers, wey believe say peace, stability, and di collective interest of Rivers State must always supersede personal or political differences.” Na so dem tok

Barile Nwakoh in pink blouse and Emilia Amadi in green dress
Wetin we call dis foto, Deputy Minority leader Barile Nwakoh and Emilia Amadi don pullout di impeachment proceeas against Gov. Fubata

Di Deputy Minority Leader for di Rivers State House of Assembly also hope say Govnor Fubara and im deputy, Prof Ngozi Odu, go retrace dia steps and honour di agreement dem reach wit President Bola Tinubu.

Dis development don make four of di 26 lawmakers wey don pull out of di process.

Earlier in di week, minority leader and member representing Omuma constituency, Sylvanus Nwankwo and Peter Abbey wey dey represent Degema Constituency, bin don call on dia colleagues to withdraw di impeachment notice dem issue on Thursday, 8 January 2026 and take di part of dialogue to resolve evri issue.

But wetin dis dia action of pulling out of di impeachment process mean, e get any effect on di process?

Sylvanus Nwankwo and Peter Abbey, members of di Rivers State House of Assembly

Wia dis foto come from, Screenshot

Wetin we call dis foto, Minority leader for di Rivers State House Assembly and im colleague from Degema Constituency na dem first pullout of di impeachment process

Wetin go happun to di impeachment process?

For Karibi George wey be lawyer and communications analyst, di one wey some lawmakers dey pullout of di impeachment process na sign say di lawmakers fit no get di two-third majority wey dey required by di constitution to impeach di govnor.

E say if according to wetin di ones wey don tok say na some of dia constituents ask dem no go fit move forward wit di process and if more constituents ask dia representatives to also pull out of di impeachment, den e mean say di impeachment process fit no work.

"Di lawmakers dey answerable to dia constituents and na wetin dia constituents ask dem to do na im dem go do.

So if like dem tok say na di pipo dem dey represent ask dem not to be part of di impeachment and dem no fit achieve two-thirds majority of di Assembly to vote in favour of di impeachment, e no gh go through."

George add say e go good if di Assembly members look for ways dem fit resolve dia fight wit di Govnor in a simple way.

E also wonder weda di Assembly don really serve di Govnor di impeachment notice as e observe say di constitution require say di Assembly suppose serve di govnor di impeachment notice personally and not by substituted means wia dem go go publish di notice for newspaper.

Dis e say if dem neva do so, e fit also mean say technically, di govnor neva receive any impeachment notice wey e go respond to.

"For me I go say make dem take di path of settling wateva fit be di issue. Already some stakeholders dey try to intervene like di Pan Niger Delta Forum Pandef as well as di Rivers State Council of Traditional Rulers Council wey din set up mediation committees for dis issue. I go say make dem make use of dis bodies wey we believe to dey neutral, and resolve evritin so di State go dey at peace."