Rate of medical negligence ginger govment to set up task force to reduce death of patients for Nigerian hospitals

Hospital for Nigeria

Wia dis foto come from, Sally Hayden/SOPA Images/LightRocket via Getty Images

    • Author, Abubakar Maccido
  • Read am in 4 mins

Federal govment don set up National Task Force on Clinical Govnance and Patient Safety to make health system strong, stop medical mistakes, and protect patients for di whole Nigeria.

Di tori come out Thursday from Coordinating Minister of Health and Social Welfare, Muhammad Pate, for im X account, wia e tok wetin di task force go do, im terms of reference, and who dey inside am.

"In line wit President Bola Ahmed Tinubu Renewed Hope Agenda and di ongoing effort to make Nigeria health system beta, Federal Ministry of Health don set up National Task Force on Clinical Govnance and Patient Safety," Pate tok.

E add say di task force go help set up and run strong clinical govnance and patient safety system, standards, and accountability wey go improve health results, better patient experience, and make health workers perform well for Nigeria.

Wetin govment tok about medical negligence?

According to di task force Terms of Reference, deaths and disabilities wey fit prevent bicos of poor care dey still spoil di progress wey don happun for health access.

"Preventable deaths and disabilities bicos of poor quality care dey still spoil di gains we don make."

Di statement wey Dr Pate release tok say plenty wahala dey for Nigeria health system like, wrong diagnosis, doctors no dey communicate well wit patients, care no dey kontinu well, accountability weak, service delivery scattered, and health workforce capacity low. Dis dey affect both public and private hospitals.

"Poor quality care still dey big wahala, especially for low- and middle-income countries like Nigeria."

According to di statement, "for low- and middle-income countries like Nigeria, about 60% of deaths wey fit prevent na bicos poor-quality care, while 40% na bicos pipo no fit access healthcare."

E still tok say, "for whole world, poor-quality care dey cause between five and eight million deaths evri year, plus big financial loss, including $42 billion wey pipo dey lose directly because of medicine mistakes."

Di statement dey show say urgent action dey necessary, sake dis numbers "show say we need national oversight sharply to reduce preventable medical harm."

medical workers

Wia dis foto come from, SDI Productions via Getty Images

Wetin govment don do before?

Di statement mention say recently di Federal govment don try fix health system, especially wit Nigeria Health Sector Renewal Investment Initiative (NHSRII) wey dem start for 2023.

Di initiative, wey follow Health Sector Strategic Blueprint (2023–2027), na to make health sector strong, resilient, and fair.

"NHSRII na to tackle old problems wey dey health sector," di statement tok.

But e add say govment need better govnance system to make sure say quality and safety dey for all health facilities.

Inside di statement wey Dr. Pate bin release e tok say di Federal Govment decide to set up national platform wey go focus on clinical govnance and patient safety.

According to Pate, di task force go support national standards and accountability.

"Di task force go help develop and run sustainable clinical govnance and patient safety system, standards, and accountability wey go improve health results, patient experience, and make health workers perform well for Nigeria," e tok.

Who dey inside di committee and wetin be im work?

Di statement tok say members go come from federal and state institutions, regulatory bodies, professional groups, and public plus private health sector.

"Members go bring dia expertise, experience, resources, and goodwill to make clinical govnance and patient safety strong for Nigeria," di statement add.

According to di statement, di task force go develop national frameworks and guidelines for patient safety and clinical governance.

"Di task force go do national analysis of clinical govnance and patient safety, den develop standard national frameworks, policies, and guide how to implement am."

E go also improve system to report and respond to patient safety incidents.

"E go strengthen system to prevent, report, learn, and respond to bad events and patient safety issues," di statement tok.

Di statement by Dr Pate say di task force go make Nigeria health system better by reducing preventable medical mistakes, improving quality of care, making patient experience beta, and boosting health worker performance.

"Setting up sustainable clinical govnance and patient safety system go improve health results, patient experience, and make health workers perform well," di statement tok.

E add say di initiative go also help achieve Universal Health Coverage, especially SDG 3.8 about quality essential health services.