Uganda President Yoweri Museveni dey lead as opposition supporters die for clash after election

A close-up of Yoweri Museveni

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

Wetin we call dis foto, Yoweri Museveni wey don dey power since 1986, dey find a seventh term
    • Author, Wycliffe Muia
  • Read am in 4 mins

Dem kill at least seven Ugandan opposition supporters overnight for circumstances, wey no clear as President Yoweri Museveni don take a strong lead inside results from Thursday presidential election.

Di opposition say security forces attack dem for di house of one MP for Butambala, about 55km (35 miles) south-west of di capital, Kampala, while police blame di violence on di opposition.

Figures wey di electoral commission announce on Friday afternoon put Museveni in front with 75% of di votes, based on returns from 60% of polling stations.

E dey followed by opposition leader Bobi Wine on 21%.

Im home for Kampala don dey surrounded by security forces "wey pu him and im wife under house arrest", Wine National Unity Platform (NUP) tok.

Di internet shutdown wey dem impose earlier in di week mean say news of di violence just dey come out on Friday for Uganda.

Opposition MP Muwanga Kivumbi tell AFP news agency say soldiers and police fire tear gas and den live bullets give hundreds of people were dey follow early results for im house.

"Dem kill ten were inside my house," e tok.

Human rights activist Agather Atuhaire confirm am give Reuters news agency.

However, local police spokesperson Lydia Tumushabe deny am, e maintain say police fire in self defence after one "group of NUP goons" bin attack one police station and plan to overrun one tallying centre.

She tell Reuters say dem bin carrying machete, axe and box of matches and say at least seven people die.

Meanwhile, some local journalists say security forces don block dem from accessing di opposition leader house for Kampala Magere area.

"Security officers don unlawfully jump over di perimeter fence and now dey set up tents within im compound," NUP post on X late on Thursday.

Police spokesman Kituuma Rusoke tell local broadcaster NBS say as a presidential contestant, Wine na "a person of interest", adding say di heavy security deployment around im house na for im own security.

After di 2021 election, wia e get 35% of di vote, security forces keep Wine for im house for several days.

Electoral chief Simon Byabakama tok on Friday say di vote counting no dey affected by di internet blackout wey dem impose earlier in di week, as di commission dey use a "private system" to transmit results from districts to di national tally centre.

Wen dem ask am about di timing of di final results announcement, Byabakama say: "We dey on course to announce di winner of di presidential election within 48 hours. Before 5 PM [14:00 GMT] tomorrow, we go get di final results."

Ugandans vote inside tense national election on Thursday after one kain campaign, with President Museveni, 81,wey dey seek a seventh term in office.

Wine, a 43-year-old pop star-turned-politician, don allege "massive" fraud during di election, wey hapun under one internet blackout. E no provide documentary proof and di authorities never respond to im allegations.

Last week, di United Nation Human Rights Office say di election go hapun under "widespread repression and intimidation".

During Thursday vote, voting bin dey delayed by up to four hours for many polling stations around di country as ballot boxes bin dey slow to arrive and biometric machines, wey dem dey use to verify voters identity, no work properly.

Some don link di problems to di network outage.

Although six oda candidates dey, di presidential poll na a two-horse race between Museveni and Wine, but sake of say di president don win di six previous elections, analysts say e go likely further extend im time in power.

Wine, wey say e represent di youth inside country where most of di population dey under di age of 30, don promise to tackle corruption and impose sweeping reforms, while Museveni argue say e be di sole guarantor of stability and progress for di country.

Di campaign period come wit palava as opposition activities dey attacked - security forces dey accused of assaulting and detaining Wine supporters.

Police spokesperson Kituuma Rusoke dismiss dis complaints, accusing opposition supporters of being disruptive.

Internet access bin dey suspended on Tuesday, with Uganda Communications Commission wey say di blackout bin dey necessary to prevent misinformation, fraud and violence - a move wey dey condemned by di UN human rights office as "deeply worrying".

Wine, wey im real name na Robert Kyagulanyi, bin don call on im supporters to protest, if Thursday election results bin dey manipulated.

However, as of Friday morning, no signs of any demonstrations dey.

A Museveni victory go extend di former rebel leader four-decade hold on power. E dey believed say e want im son, military chief Muhoozi Kainerugaba, to succeed am, though e deny say e dey groom am for di role.

Di final presidential result dey expected to dey announced by 16:00 local time (13:00 GMT) on Saturday, according to di electoral commission.

Additional reporting by Sammy Awami in Kampala