79 Nigerians, 18 Ghanaians wey dey on US criminal list dey face deportation

Pipo wan go enta plane. Security stand by.

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 3 mins

President Donald Trump administration don announce plans to deport 79 Nigerians wey dia names dey on di kontri "worst of di worst" criminal list.

18 Ghanaians plus citizens of oda African kontris wey dem describe as 'criminal illegal aliens' also dey di list.

For di list wey US Homeland Security bin publish on dia website on Monday, 2 February, Immigration and Customs Enforcement (Ice) arrest more dan 1,000 pipo from different kontris ova di weekend on top deadly crimes wey include serious sexual assault of elderly/disabled pesin, automobile homicide, fraud, robbery, and trafficking fentanyl.

One short statement from di agency say di convicts wey chop arrest na part of di United States crackdown on criminal immigrants.

"Di US Department of Homeland Security dey highlight di worst of di worst criminal aliens wey di US Immigration and Customs Enforcement arrest.

"Under Secretary Noem leadership, di hardworking men and women of DHS and Ice dey fulfil President Trump promise and carrying out mass deportations, starting wit di worst of di worst, wey include di illegal aliens you see for hia, " di statement read.

African kontris wey dey di list include:

  • Nigeria - 79 pipo dey face deportation on top crimes wey border mostly on fraud, theft, sexual assault, drug trafficking, among odas.
  • Ghana – 18 pipo dey face deportation on top crimes wey dey mostly on homicide, assault, trafficking, identity theft, extortion and money laundering.
  • Kenya - 28 pipo dey face deportation on top crimes wey dey mostly on drug trafficking, assault and theft.
  • Burkina Faso - 5 on crimes wey dey mostly on mail fraud and sexual abuse of minor.
  • South Africa - 6 on crimes wey dey mostly on abuse and robbery.

Ice don make thousands of arrests since US President Donald Trump return to di White House for January 2025.

Most of dis arrests often na for public places, wey don lead to a number of clashes as protesters wey dey against di agency operations.

Na Ice dey take di lead in carrying out di Trump administration mass deportation initiative, wey be central promise of Trump election campaign.

For January, DHS say under di leadership of Donald Trump, dem don remove more dan 670,000 illegal aliens wey include murderers, paedophiles, rapists, gang members, and terrorists from American communities and anoda two million don self deport.

DHS dey committed to continue to remove dangerous illegal aliens from American communities. Di agency add say 70% of arrests wey Ice make na of criminal illegal aliens wey don dey convicted or charged wit crime for di US.

Dem say dem no go rest until American communities dey free of di scourge of illegal alien crime.