Seven Ghanaians die afta jihadist attack tomato traders for Burkina Faso, odas injure

Wia dis foto come from, THOMAS IMO/PHOTOTHEK VIA GETTY IMAGES
Ghana interior minister Mohammed Muntaka Mubarak don confam say jihadists kill seven Ghanaian tomato traders for Burkina Faso when dia supply truck reach one town dem call Titao.
Di militants wey allegedly attack one military site for di area – target soldiers and civilians on 14 February.
Dem dey reportedly enta di Titao area since 2019 wey dem dey attack pipo between Titao and Ouahigouya.
Di jihadist group Jama'a Nusrat ul-Islam wa-al-Muslim (JNIM) dey often claim responsibility for attacks on security and odas for dat area.
Ghana interior minister say according to di information he get, "di jihadists enta di town wey dem gada everibody especially di men; na dem be di target."
Oga Mohammed Muntaka Mubarak tell local radio station Joy Fm say "unfortunately, dem attack our traders for dia truck. Dem separate di men from di women wey dem begin to shoot."
"Dem kill almost all di men wey dem burn dem togeda wit di truck. Unfortunately, we get some Ghanaians on top dis truck; di driver and nine oda men and eight women."
Di interior minister explain say "seven of di men die wey dia body burn beyond recognition, three oda pipo hurt; one of di women im condition dey severe."
"Di oda women dia injuries no be severe. But di information we get be say di bodies of di pipo wey die already begin to dey rot, dem block di whole area so pipo no fit enta di place now."
Di latest information by di minister confam wetin di tomato traders association tok afta di attack.
Di bodies wey burn dey almost 'rot'

Wia dis foto come from, OLYMPIA DE MAISON/AFP VIA GETTY IMAGES
Di association president Eric Tuffour tok say traders wey dey travel along di border to buy tomatoes and onion dey suffer sake of dem dey face many attacks but dis one pass all di previous cases.
Oga Eric Tuffour tok say di driver of di truck try to lock imsef inside wen dem dey carry out dia attack but las las, dem set di truck on fire, na so di pipo burn.
Di interior minister say he dey in connection wit di security minister for Burkina Faso wey dem dey try to figure out how to deal wit di mata.
"We don ask our officials for di Ghana embassy to witness di burial of our pipo wey die but e dey difficult sake of dem block all di route to di place wey di situation still dey hot."
Oga Muntaka Mubarak say authorities for Burkina Faso dey work to "reclaim di city wey dem confam say dem go bury di bodies wey already begin to dey rot, on Monday."

Wia dis foto come from, CRISTINA ALDEHUELA/AFP VIA GETTY IMAGES
"We don ask our women wey dey involved but dem no hurt and those wey get small injuries say make dem witness di burial and capture wetin dem fit capture – pictures and videos."
Muntaka Mubarak say "Burkinabe authorities don assure us say afta di burial, dia military go create safe way to move di women – di ones wey hurt and di ones wey no hurt to our mission for Ouagadougou."
Burkinabe authorities no comment for dis mata yet, but for Ghana, di tomato traders association say di incident really shock dem.
Dem wan make govment use dis case to provide proper security along di border and oda route for traders wey dey travel to carry vegetables to Ghana from Burkina Faso.
Di association say dem go soon identify all di pipo wey dey affected by dis attack so dem fit begin to plan wetin dem go do next.







