Fotos: Katy Perry return to Earth afta all-female spaceflight

Wia dis foto come from, Blue Origin
US Pop star Katy Perry and five oda women safely return to Earth afta dem reach space on board Jeff Bezos' rocket.
Di singer join Bezos fiancée Lauren Sánchez and CBS presenter Gayle King, wey say her highlight of di flight na wen she hear Perry sing Louis Armstrong song "What a Wonderful World".
Di New Shepard rocket lift off from dia West Texas launch site just afta 08:30 local time (14:30 BST).
Di flight last around 11 minutes and im take di six women more dan 100km (62 miles) above Earth, e cross di internationally recognised boundary of space and e give dem a few moments of weightlessness.

Also on board na former Nasa rocket scientist Aisha Bowe, civil rights activist Amanda Nguyen, and film producer Kerianne Flynn.
Di capsule return to Earth wit one parachute-assisted soft landing, while di rocket booster also land back for Texas.
You go hear pipo dey cheer from inside di capsule as di recovery crew go to collect dem.
Jeff Bezos open di capsule door to welcome back Lauren Sánchez, di first to come out.
End of Di one wey oda users dey read well well
"I dey so proud of dis crew," she tok wit tears for her eyes. "I no fit put am into words."
She pause, bifor she add say : "I look out of di window and we see di moon."
"Earth bin look so quiet," she add say no be wetin she expect. "E dey quiet, but really alive."
Next out na Katy Perry, wey kiss di ground and lift one daisy to di sky - her daughter name na Daisy.
Gayle King also go on her knees and kiss di ground.
"I just want to get a moment wit di ground, just appreciate di ground for just a second," she tok.
Di last to come out, na Kerianne Flynn, she point to di sky and shout: "I go space."
One celebrity cast bin watch di launch from di ground.
Speaking from di viewing platform, Khloé Kardashian say: "I bin no realise how emotional e go be, E dey hard to explain. I get all dis adrenaline and I just dey stand hia."
Di spacecraft bin dey fully autonomous, e no require pilots, and di crew bin no manually operate di vehicle.
"If you bin tell me say I go dey part of di first-ever all-female crew in space, I for believe you. Nothing dey beyond my imagination as a child. Although we no grow up with much, I never stop to look di world wit hopeful WONDER!" Perry tok for her social media post prior to di launch.
Blue Origin say di last all-female spaceflight na ova 60 years ago wen Soviet Cosmonaut Valentina Tereshkova become di first woman to travel into space on a solo mission aboard di spacecraft Vostok 6.
Since den, no oda all-female spaceflights but women don make numerous significant contributions.

Wia dis foto come from, Blue Origin
"Di highest high. Na to surrender to di unknown," Perry tok afta she land back on Earth.
Perry say she really enjoy di flight
Dem ask her if she go record a song about her experience she say "100%" and she add say she feel "really connected to dat strong, divine feminine right now".

Wia dis foto come from, BLUE ORIGIN

Wia dis foto come from, BLUE ORIGIN

Wia dis foto come from, BLUE ORIGIN

Wia dis foto come from, BLUE ORIGIN

Wia dis foto come from, BLUE ORIGIN














