How to know if a company dey registered for Nigeria as CAC issue ultimatum for unregistered businesses

Wia dis foto come from, Corporate Affairs Commission/X
Di Corporate Affairs Commission (CAC) don issue six-week notice give unregistered businesses to register wit di Commission.
Di commission announce dis informate for one statement dem publish on dia social media account on Tuesday, 29 April.
For di statement, CAC warn say failure to comply wit di notice go attract jail term or prosecution.
"Na criminal offence under Section 863 of di Companies and Allied Matters Act, 2020, to do business for Nigeria as a company, limited liability partnership, limited partnership, or under a business name without registration," di commission tell kontri pipo.
CAC add say na offence for a business to operate under a name (or acronym) wey different from di one registered under di Act.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Dem further advise Nigerians to obey Section 729 of di Act, wey require every registered company to display dia registered name and registration number for every business location.
"In addition, di company dey required to state dia registered name and registration number on all dia official publications, wey include letterheads, signage, marketing, and publicity materials," di statement add.
CAC tok say non-compliance wit business registration requirements fit result in prosecution and conviction wey carry penalty of up to two years imprisonment.
How to know if company or business dey registered wit CAC
For corporate body or business to carry out services for Nigeria, e must dey registered wit di Corporate Affairs Commission (CAC). To successfully register company for di kontri, di company for don meet all di necessary requirements of di commission wey include provision of di company details, like (Name of di company, registered address, directors, shareholders, shareholding formula etc) and dem must don pay di commission compulsory filing fees.
Afta di commission register di company, CAC go issue di company Certificate of Incorporation, wey contain di name of di company and dia status (weda na private or public company), and RC Number wey dey unique to dat company. Di certificate also carry di date plus di seal of di Registrar-General of the commission.
To ensure say pipo no fall mugu for magomago business or company, di CAC bin launch one public search portal on dia website wia pesin fit confam di registration of a company.
CAC say to confam if company or business dey registered, pipo fit search dia website by clicking on Public Search, den dem go put di company or business RC number or full name for di search box and press search. If di company or business dey registered, di name, RC number and office address go show.
Di CAC online check go only show weda di company dey duly registered wit di commission or not. Di search result go include di registered office address of di company and di registration number (RC), but e no go include di names or particulars of di directors and shareholders of di company.

Wia dis foto come from, Corporate Affairs Commission/X
How to register a company a business for Nigeria
Di Corporate Affairs Commission na di agency wey dey backed by law to register company or business for Nigeria, weda private or public company, big or small business.
According to di CAC website, di process to register dey simple. Di first tin na for di applicant to visit di website and follow di informate dem put for dia.









