Canada election 2025 results inside charts

- Author, Phil Leake, Alison Benjamin, Daniel Wainwright and Jess Carr
- Role, Data journalism team
- Read am in 2 mins
Mark Carney Liberal Party don win di Canadian election.
For im victory speech, Carney tell supporters say: "President Trump dey try to break us so dat America fit own us - dat no go ever happen".
E remain too close to call weda e go secure a majority in parliament, or e go need to rely on oda parties to govern.
Meanwhile, di defeated Conservative leader Pierre Poilievre say dem don learn "hard lessons".
Di projected result na ogbonge turnaround for di Liberal Party, wey bin dey back for di polls just three months ago, before Carney replace Justin Trudeau as leader and US President Trump begin worry dia relationship wey become key issue of di campaign.
Carney Liberals dey lead in more dan 150 seats but dem currently dey short of di 172 needed for a majority.
Di Conservatives, wey Pierre Poilievre lead, dey set to remain in opposition as di second-largest party.
Di remaining seats dey shared between di Bloc Québécois - wey only get candidates for di province of Quebec - di New Democratic Party (NDP) and di Green Party.
Canada dey use di "first-past-the-post" electoral system.
Di candidate wey get di most votes in each electoral district, or riding, win di seat and become a Member of Parliament (MP).
Di Liberals and di Conservatives don dominate di popular vote, with both parties receiving more dan 40% of ballots counted across Canada so far.
E put dem on track to win a combined 90% of seats.
Both di Liberals and di Conservatives don record a significant rise in dia share of di national vote compared with four years ago.
Increased support for Canada two largest parties don come at di expense of smaller parties, particularly di NDP wey im share dey down by around 12 percentage points.

Di Liberals dey on course to win di most seats for di key provinces of Ontario and Quebec, wey account for 200 of Canada 343 electoral districts.
Di Conservatives dey ahead for Alberta, while e get little to choose between di two main parties for British Columbia.








