Nnamdi Kanu news: I dey very happy wen I hear di news - Govnor Nasir El-Rufai

Kaduna State Govnor Nasir El-Rufai

Wia dis foto come from, NASir El-Rufai/Facebook

Wetin we call dis foto, Kaduna State Govnor Nasir El-Rufai

Di govnor of Kaduna state Nasir El-Rufai don tell BBC Pidgin say e bin happy wella wen e hear say di Nigerian goment don arrest IPOB leader, Nnamdi Kanu.

Di govnor tok inside exclusive interview say wetin Kanu dey do dey increase violence for di kontri and e go good for am to face justice.

"I dey happy wen I hear about Kanu arrest and I congratulate di federal goment. Dis na pesin wey dey fan violence for Nigeria and na good to tin for am to face justice."

On di issue say goment no dey act fast-fast ontop oda similar issues like banditry and Boko Haram, El-Rufai say pipo dey compare 'apples and oranges' as dem no be di same issue.

"Kanu issue na different issue to dis ones u mention, im dey call for separation of Nigeria in violent way and e still hold Nigeria passport."

"Nnamdi Kanu arrested today": [Ipob news] 'Nnamdi Kanu extradition arrest' in Nigeria ', go appear for Nigeria court - 'Abubakar Malami'

Wia dis foto come from, Other

Wetin we call dis foto, Nnamdi Kanu on 29 June, 2021 after im arrest and return to Nigeria.

Na on Tuesday 29, June 2021, Nigeria Minister of justice and Attorney General of di federation Abubakar Malami break di tori say dem arrest Nnamdi Kanu on Sunday 27, June.

Oga Malami say dem repatriate alias return Kanu to Nigeria.

E no dey clear yet where dem arrest Kanu but UK don tok say no be for dia land dem arrest di Ipob leader wey also be citizen of UK.

"We want to inform Nigerians say goment working with security agencies don succeed in attempt to gbab Nnamdi Kanu and we don bring back come Nigeria."

Malami tell tori pipo for Abuja, di kontri political capital, on Tuesday Afternoon.

"Kanu go still answer for di 11 charges wey e bin dey face for court before e try to escape justice and we don already re-present before court." E bin tok.