Wetin be di dart frog toxin wey dem allegedly use to kill Russian opposition leader Alexei Navalny?

Wia dis foto come from, Getty Images
Dem kpai Russian opposition leader Alexei Navalny wit di use of deadly toxin, wey dey come from poison dart frogs for South America, di UK and some of European allies don tok.
Dem find traces of epibatidine for samples from Navalny body, and e fit be di cause of im death for di Siberian penal colony two years ago, di UK Foreign Office tok.
Di allies tok say na only di Russian state get di "means, motive and opportunity" to deploy dis dangerous toxin.
Kremlin dismiss di finding, dem call am "information campaign", according to Tass news agency.
Wetin be di toxin?
Epibatidine na natural neurotoxin wey dem collect from di skin of Ecuadorian poison dart frog, according to toxicologist Jill Johnson.
E dey "200 times more strong" dan morphine, she tell BBC Russian.
You fit find epibatidine naturally for dart frogs in di wild for South America and dem dey make am for laboratory.
Dart frogs wey dey for captivity no dey produce dis toxin and you no fit find am naturally for Russia, di European allies tok for dia statement.
Di species wey dem sabi as Anthony poison arrow frog and di Phantasmal poison frog na among di ones wey dey release di toxin for dia skin.
Although dem don investigate epibatidine as painkiller and as relief for painful inflammatory lung conditions, dem no dey use am clinically becos of di toxicity.
How dart frog poison dey work?
Dis powerful chemical compound dey act for di nicotinic receptors for di nervous system, according to Johnson.
E dey overstimulate dis nerve receptors, if e dey dosed correctly, e fit cause muscle twitch, paralysis, seizure, slow heart beat, respiratory failure and death, she tok.
Alastair Hay, wey be professor of environmental toxicology for University of Leeds, tell PA say di effects fit make pesin breathe block, and say "any pesin wey dem use am poison fit die from suffocation".
If dem find di toxin for pesin blood, e suggest "say dem administer am deliberately", e add.
Epibatidine toxicity fit even "increase if dem combine am wit some oda drugs and dem don research dis combinations", Hay tok.
How rare di toxin be?
Epibatidine dey very rare and dem fit find am for only for one geographical region and na small amount, Johnson tok.
Dem say di dart frog wey UK Foreign Office and odas dey refer to na Anthony's poison arrow frog, wey dey only for Ecuador and Peru.
Di frogs dey produce di chemical by eating di right food wey go make am produce alkaloids - na one type of organic compound - wey dey form epibatidine and accumulate for dia skin. If di frog diet change, e go finish di epibatidine wey dem get.
"To find wild frog for di right place, wia e dey eat di exact food wey e need to produce di right alkaloids, e dey... almost impossible," Johnson tok.
"Dis na incredibly rare method of human poisoning. Di only oda cases of epibatidine poisoning wey I sabi na laboratory-based and na non-fatal."
Wetin Russia tok?
European laboratories don confam say Navalny die from some kind poison wey no clear, allies tok for Saturday.
Moscow bin don tok say Navalny die by natural cause, but im widow, Yulia Navalnaya, dey insist say dem 'murder' am by poisoning.
Di Russian embassy for London deny say Moscow involve for Navalny death and describe di announcement as 'feeble-mindedness of Western fabulists' and 'necro-propaganda'.
Kremlin tok-tok pesin Maria Zakharova tok for Russian state news agency Tass say: 'All di toks and statements na information campaign wey dem wan use to distract pipo from di West pressing problems.'
Hamish de Bretton-Gordon, wey be former UK and Nato senior officer and chemical weapons expert, tok say make pipo take anything wey Kremlin dey tok, including about Navalny death, 'wit a pinch of salt'.
E tell BBC Radio 4's Today programme say, Nato kontris "don demonstrate say dem get evidence say na di state kill Navalny."
At di time dem kill am, Navalny don dey prison for three years and dem don transfer am to one Arctic penal colony.
According to Russian accounts, di 47-year-old waka small, e tok say e no dey feel well, den e collapse and e no wake up again.










