Wetin be Thallium sulphate ‘poison’ wey El-Rufai write to NSA Nuhu Ribadu about

Foto of Nasir El-Rufia and Nuhu Ribadu

Wia dis foto come from, Nasir El-Rufia/facebook, Nuhu Ribadu/Facebook

    • Author, Adebola Ajayi
    • Role, Journalist
    • Reporting from, Lagos
  • Read am in 4 mins

Di former Kaduna State Govnor, Nasir El-Rufai don write official letter to National Security Adviser, Nuhu Ribadu, to seek clarification ova reports say di National Security Adviser (NSA) import about 10 kilograms of thallium sulphate, wey dey highly toxic and strictly regulated into Nigeria.

El-Rufai inside one post on X wia e post di letter e address to NSA, tok say im bin write one letter dated to 11 February to Ribahu as a concern citizen to clarify "di importation of thallium sulphate by im office."

Inside di letter, El-Rufai tok say im dey act as concerned citizen and e wan make sure say information allegding say dem source and import di chemical from supplier in Poland.

E ask NSA make e clarify wetin e wan use di substance do, di identity of di supplier, and weda appropriate authorities allow dem make import get di chemical.

Thallium Sulphate, na di colorless, crystalline chemical compound wey dey very poisonous and strictly regulated for many kontris, research show.

Thallium dey widely used as rat poison, e dey very poisionous and di biological signs of dis fatal poisoning still dey unclear and e dey hard to find, just like di histologic lesions wey e dey cause am.

Although dem fit find am inside some rat poison and insecticides, but since di 1970s, many kontris don dey control di sales becos of di toxicity.

Di salts of thallium dey colourless, odourless, tasteless, and dem fit dissolve inside water. If e enta into di body system, e go attack di nervous system and internal organs. E go cause hair loss, vomiting, and diarrhoea. Di early symptoms of poisoning dey often confuse wit many viral diseases like influenza, dis fit delay how dem go detect am.

Within three days afta poisoning, victims go suffer headache, muscular pains, convulsion, coma, delirium, dementia and even psychosis.

Even small dose like one gram fit kill pesin.

Foto of colorless, crystalline chemical compound wey dey dey call thallium sulphate inside container

Wia dis foto come from, Kraus/Bloomberg via Getty Images

On Friday, Inside one interview wit Arise TV, Elrufai allege say di NSA boss order make authorities arrest am and na im dey behind di attempted arrest wey bin happun for Nnamdi Azikiwe International Airport.

El-Rufai tok say im hear say na Ribahu tell security officials make dem hold am through phone calls.

"Nuhu make di call and make di order say I must dey custody yesterday," e tok

"Dem tap NSA call, dem dey do am to our calls too, and we hear am wia e tok say make dem go arrest me. Govment dey tink say dem be di only ones wey fit hear call. But we still get our way."

El-Rufai, don dey accuse di Tinubu adminstration of political witch-hunt and e tok say dem send am ICPC and EFCC invitation and im go honour dia invitation.

Foto of di letter wey Nasir El-Rufai write to NSA and foto of Nasir Ahmad El-Rufai

Wia dis foto come from, Nasir Ahmad El-Rufai/X

El-Rufai also request for details on di total quantity and concentration wey dem buy, storage and security arrangements, and regulatory oversight wey involve NAFDAC and di Nigeria Centre for Disease Control (NCDC).

E also ask weda dem don do any public health risk assessment or hazard-mitigation plan becos di level of how very toxic di substance dey.

"I dey write as concerned citizen wey dey seek clarification and reassurance regarding information available to political opposition leaders about procurement of about 10 kilograms of Thallium Sulphate by your office (ONSA), wey dem say una buy from one supplier for Poland," El-Rufai tok.

"Thallium salts dey highly toxic and na tightly controlled substances, I believe say e dey important- for public safety, democratic accountability, and to maintain public trust to confam dis details:

1. Wetin be di intended purpose and end-use of di imported thallium sulphate

2. Who be di supplier and weda dem import di material under any existing chemical or defence permit.

3. Di total quantity and di specific form or concentration wey una don buy.

4. Di storage and security arrangements for di material wen e arrive.

5. Wetin be di regulatory oversight and coordination wey dey happun wit NAFDAC, NCDC, and relevant public-health and environmental agencies.

6. Weda dem don develop any public-health risk assessments or hazard-mitigation plans, considering say di compound dey very toxic.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post