El-Rufai don enta presidency wahala? - Wetin to know about former Kaduna govnor

Foto of Nasir El-Rufai, former govnor of Kaduna States wey wear black cap and light blue top sidon on top brown chair

Wia dis foto come from, Nasir El-Rufai/X

Read am in 6 mins

Since di former govnor of kaduna States, Nasir El-Rufai don comot from office e don face several political controversies and crisis.

Recently, El-Rufia bin escape di attempt by di security officials wey wan arrest am for Nnamdi Azikiwe International Airport in Abuja on Thursday, afta im arrive in di kontri from Cairo, Egypt.

Tok-tok pesin to El-Rufai, Muyiwa Adekeye, tok say im oga no gree follow di security agents wey wan arrest becos dem no get any arrest warrant but dem seize im international passport and beat one of im aide.

"Malam El- Rufai no gree to follow dem without formal Invitation. Dem snatch im international passport from one aide," Muyiwa Adekeye tok.

Di Presidency call for full investigation into wetin former Kaduna State govnor, Nasir El-Rufai bin alleged about wire-tapping of di National Security Adviser phone line.

Inside im interview on Arise TV, Elrufai allege say di National Security Adviser (NSA) Nuhu Ribadu order make authorities arrest am and na im dey behind di attempted arrest for Nnamdi Azikiwe International Airport.

E defend di legality of di phone interception, as e gree say technically e dey illegal but claim say, "di govment dey do am all di time. Dem dey listen to our calls without court order. But pesin tap im phone and tell us say na im give di order."

Reacting on Friday afta El-Rufai interview on Arise TV, tok-tok pesin to di president Bayo Onanuga raise concern about di implications dis claim mean for national security.

"El-Rufai don confess to wire-tapping Nigeria NSA for TV. Wetin e mean say im and im collaborators dem get wire-tapping facilities?" Onanuga ask.

E add say dem no suppose ignore dis matter, stressing say accountability dey important.

"Dem one suppose dey thoroughly investigated and punishment suppose follow. El-Rufai no too big to face di wrath of di law," e tok

Foto of Nasir El-Rufai and Atiku Abubakar

Wia dis foto come from, Atiku Abubakar/X

Di former govnor don dey openly criticise di Bola Tinubu administration and di rulling party afta e comot from di rulling party to join African Democratic Congress (ADC) claimimg dat di party no longer align wit im values.

Dis fit be a major reason security dey invite am for questioning, as many oda party members don receive previous invite.

On Friday, El-Rufai, ontop im X account claim say e bin receive invitation from Independent Corrupt Practices and Other Related Offences Commission (ICPC) and im go appear for dia office on Wednesday, February 18, 2026.

El-Rufai tok say ICPC bin write to am on Feburary 12 say make e appear for dia office by 10:00am on Feburary 13 but im lawyer write back say im go present himself for di commission on Wednesday, 18 February 2026.

Inside di interview wit Arise TV, di former govnor of Kaduna state tok say im be law abiding citizen and e go honour di invite by di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) on Monday as e "no get anything to hide."

Both EFCC and ICPC dey investigate corruption matta against Mr El-Rufai but dem neva tell di public openly wetin be di allegations against di former governor of Kaduna State.

Buhari allies wey dey face corruption charges

Chris Ngige, Abubakar Malami, Timipre Sylva, Hadi Sirika

Wia dis foto come from, Chris Ngige/Abubakar Malami/Timipre Sylva/Hadi Sirika/Facebook

Many political opposition parties don criticise, Tinubu adminstration say allies of late president, Muhammadu Buhari dey face corruption charges under dis adminstration afta dem bin fall out wit di govment depsite di support dem give during di 2023 presidential election.

However, no be only El-rufai dey inside gbege wit di anti-graft agencies di EFCC don sama 16-count charges against di former Attorney General of di Federation and Minister of Justice, Abubakar Malami for Federal High Court, Abuja.

Afta, e complete im bail conditions, di security official later arrest Malami again.

Former govnor of Sokoto State, Aminu Tambuwal bin face corruption charges ova withdrawals of 189 billion naira ($123 million) during im tenure as govnor.

In 2025, ADC don critise di Tinubu admistration and di anti-graft agency say dem dey allow politicians to dey use dem as tools against opposition party members.

On Thursday night, former vice-president, Abubakar Atiku tok say e bin visit Nasir El-Rufai, stalwart of di African Democratic Congress (ADC), afta di "failed attempt by di partisan ICPC to arrest am at di airport upon im arrival into di kontri."

Who be Nasir El-Rufai and wetin pipo sabi about am?

Foto of Nasir El-Rufai

Wia dis foto come from, Nasir El-Rufai/Facebook

Dem born Malam Nasir Ahmad El-Rufai on 16 February 1960 for Daudawa, Katsina State, Nigeria, but originally from Zaria.

El-Rufai attend Barewa College, Zaria, wia e win "Best Graduating Student" for 1976. One of im classmates na former President Umaru Musa Yar'Adua.

Later, e study Quantity Surveying for Ahmadu Bello University (ABU), Zaria, and graduate wit First-Class degree for 1980. E latter go study Business Administration, Law, and Public Administration from Harvard University and Georgetown University for United Sttes of America.

In 1999–2003, e serve as director-general of di Bureau of Public Enterprises (BPE), den former president Olusegun Obasanjo appoint am as secretary for National Council on Privatization.

E later become di minister of di Federal Capital Territory (FCT) between 2003–2007, afta e leave office for 2007, El-Rufai face political issues under former president Umaru Musa Yar'Adua adminstration.

Dem accuse am of corruption and misusing power, wey lead to legal fights wit di EFCC.

With all di pressure, e enta self-imposed exile, den e go study for Harvard University and do international consultancy.

In 2010, El-Rufai come back to Nigeria afta former president Yar'Adua die and enta into national politics.

In 2015, El-Rufai contest and win Kaduna State govnorship election under di All Progressives Congress (APC).

As governor of Kaduna State from 2015 to 2023, El-Rufai tenure face several issues including insecurity.

Kaduna State bin turn hot spot for ethno-religious killings, especially for Southern Kaduna wia minority Christian dey live.

In 2019, massacre bin happun for Kajuru local government wia 141 pipo die.

Idris Abubakar, wey pipo sabi as Dadiyata disappear from im compound for Barnawa, Kaduna State.

Di 34-year-old lecturer for Federal University Dutsin-Ma, na critic of di Kano state govment, Rabiu Kwankwaso.

Since e disappear in 2019, im family and several human rights groups don file plenty lawsuits making make dem release am.