How Russia dey take recruit fighters for war wit Ukraine - Nigeria govment warn citizens

Wia dis foto come from, Virojt Changyencham/Getty Images
Nigeria foreign ministry don raise alarm ova citizens wey dem dey illegally recruit to go fight for foreign wars.
Inside one statement wey dem release on Sunday, di ministry tok-tok pesin, Kimiebi Imomotimi Ebienfa talk say: "Many Nigerians don fall victim to dis unfortunate situation wia dem send dem go combat zones afta dem mislead dem and force dem to sign military service contracts."
Officials tok say investigation and security report show say dem lure some Nigerians wit promises of beta jobs, security work, education opportunities, or migration incentives.
Early dis week, Ukrainian authorities tok say dia military intelligence operatives find bodies of two Nigerian citizens for Luhansk region.
Dem say both men don sign contract wit Russian army for second half of 2025 and dem send dem go occupied territory wit little or no military training.
According to Ukraine, dem kill dem for late November while dem dey attempt to storm Ukrainian positions.
Nigeria foreign ministry tok say dem dey use recruitment tactics wey include high salary offers, signing bonuses, and fast-tracked citizenship.
For some cases, victims dey force to sign contracts for foreign languages without correct legal advice, and dem dey collect dia travel documents wen dem arrive.
Intermediaries dey help dem arrange travel using tourist or oda non-military visa.
"Ministry of Foreign Affairs for Federal Republic of Nigeria don show serious concerns about how Nigerian citizens dey fall victim to illegal recruitment to join foreign armed conflicts," di statement tok.
"Recent media investigations and security reports don show say some Nigerians dey recruit under false pretenses, wey include promises of big jobs, security work, educational opportunities, or migration incentives."
Oga Ebienfa don warn Nigerians make dem no accept such offers, say e dey put life for risk and e fit breach Nigerian and international laws on mercenary activities and foreign enlistment.
Di government tok say dem dey work wit local and international partners to investigate di cases and increase public awareness. Nigerian missions abroad don also receive directive to strengthen consular support and give timely advice to citizens.
"Di federal govment of Nigeria don warn all di citizens make dem no engage or accept any offer wey fit involve foreign armed. Dis kind action no just dey put lives for danger, e fit also violate Nigerian and international laws wey dey control mercenary work and foreign enlistment," di statement tok.
"Di Ministry wan make am clear say Nigerians wey choose to join foreign conflicts without govment approval dey put dia own life at risk."
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Ova 1000 Africans join Russian Army between 2023-2025- Ukrainian authorities report
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Ukrainian intelligence estimate say ova 1,400 pipo from 36 African kontris na im Russian don recruit to fight for dem. Ukraine don also face criticism for trying to recruit foreign citizens, including Africans, to join dia side.
Tension between several African nations and Russia on top di recruitment of African men to fight for Ukraine dey likely to increase afta officials for Kyiv announce say dem don discover di dead body of two Nigerian men for Donbas region.
On Thursday, di Ukrainian Defence ministry release di photographs of di two Nigerians wey dem allege say die as dem dey defend Russia.
Di ministry say dem find di bodies of Hamzat Kazeem Kolawole and Mbah Stephen for Luhansk, and claim say both of dem bin sign up to join di Russian army for 2025.
Kolawole, 42 and Udoka, 37, join di Russian military 423rd Guards Motor Rifle Regiment, part of di 4th Guards Kantemirovskaya Tank Division, wit no military training bifor dem deploy dem go di front line, di Ukraine military tok.
"Udoka no receive any training whatsoever — just five days later, on October 3, dem assign am to di unit and send am go di temporarily occupied territories of Ukraine.
"Kolawole no get any record of training, e dey very likely say e neva receive any military training. Im wife and three children dey for Nigeria," di statement tok.
Di deaths dey come for di middle of growing concern for many Africa nations about di number of men reportedly being recruited to fight for Russia.
African govments don dey give warning to dia citizens and dem dey work to bring back di pipo wey don already join di war.
On Tuesday, South Africa tok say Russian President Vladimir Putin don promise to help bring back South African citizens wey travel go Ukraine to join Russian forces.










