Obama address Donald Trump racist video wey show am as ape

Obama seen on di campaign trail for November 2025

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Obama seen on di campaign trail for November 2025
    • Author, Max Matza
  • Read am in 4 mins

Former US President Barack Obama don indirectly address one racist video rwey President Donlad Trump post on social media, wia e tell one podcast host say di "shame" and "decorum" wey once guide public officials don lost.

Di video wey fit make pesin vex include di part wey show Obama and im wife Michelle as apes, wey draw general criticism from Democrats and Republicans.

Di White House bin initially defend di video, calling backlash "fake outrage". Dem later tok say na one staff member post am and den delete di video.

Obama tok to liberal podcaster Brian Tyler Cohen, wey ask di first black US president about di tone of political discourse. Cohen cite Trump post among several recent controversies.

Di clip – wey get di song The Lion Sleeps Tonight – dey for di end of a video Trump Truth Social account share wey contain baseless claims about voter fraud in di 2020 election.

Di post lead to anger from politicians, including from senior members of Trump Republican party.

Senator Tim Scott – di only black Republican senator – describe am as "di most racist tin I don see out of dis White House".

Di clip recall racist pictures wey compare black pipo to monkey, and be like say dem take am from one X post wey conservative meme creator Xerias share for October.

Trump don tell tori pipo say im "no see" di part of di video wey show di Obamas.

"I no make mistake," e tell reporters wen dem ask whether e plan to apologise.

Dem release di 47-minute podcast wey feature Obama on Saturday. Di episode start wit ddi host wey ask am to comment on US "discourse", which e say "don come to a level of harshness wey we neva see before".

Cohen note claim by di White House say di "victims" of Immigration and Customs Enforcement (ICE) na "domestic terrorists", and add "just days ago, Donald Trump put a picture of you, your face, on ape body".

Obama respond by saying: "E dey important to recognise say di majority of di American pipo dis behaviour deeply troubling.

"Na true say e dey get attention. Na true say na distraction."

But Obama say while im dey travel around di US, e find imsef dey meet pipo wey "still believe in decency, courtesy, kindness".

"E dis kind clown show wey dey happen for social media and on television," e kontinu.

"And di truth be say shame no dey about dis among pipo wey bin dey feel like you gatz get some kain level of decorum and a sense of decency and respect for di office, right?

"Dat one don loss."

E no mention Trump by name for im response.

During di interview, Obama take about different issues. E praise protesters wey don peacefully organise against immigration operations, discuss electoral redistricting and tok about im presidential library, wey go soon open for Chicago next year.

Wetin we call dis Video, Watch: Trump say e 'no see' di racist clip wey show di Obamas as apes