Russia use dart frog toxin kill opposition leader Alexei Navalny, UK tok

Wia dis foto come from, Reuters
Na one poison wey dem develop from a dart frog toxin dem use kill Russian opposition leader Alexei Navalny, di Foreign Office don tok.
Two years on from di death of Navalny for one Siberian penal colony, Britain and dia allies don pin di blame on di Kremlin following analysis of material samples dem see for im body.
Innocent explanation no dey for di toxin, wey dem dey call epibatidine, wey dem see for samples wey dem take from Navalny body, di Foreign Office add.
Foreign Secretary Yvette Cooper wen e dey tok for Munich Security Conference say: "Only di Russian govment get di means, motive and opportunity to deploy dis kain deadly toxin against Alexei Navalny during im imprisonment in Russia."
While Cooper announce di findings, UK, Sweden, France, Germany and Netherlands issue joint statement.
Cooper meet Navalny widow, Yulia Navalnaya, for di conference dis weekend.
"Russia see Navalny as threat," Cooper tok for di event.
"By using dis kain poison di Russian state show di despicable tools wey dem get at dia disposal and di overwhelming fear wey dem get for political opposition," she add.
Inside di statement di allies tok say: "Only Russian state fit get di means, motive, and opportunity to deploy dis lethal toxin to target Navalny during im imprisonment for Russian penal colony in Siberia, and we dey hold dem responsible for im death.
"Dem fit find epibatidine naturally for dart frogs in di wild South America. Dart frogs wey dem keep for captivity no dey make dis kind toxin and dem no fit find naturally for Russia.
"No innocent explanation ova im presence for Navalny body."
Di Foreign Office tok say UK don inform Organisation on di Prohibition of Chemical Weapons about Russia wey allegedly breach di Chemical Weapons Convention.
French Foreign Minister Jean-Noël Barrot tok say im kontri "dey pay tribute" to Navalny, e tok say dem "kill am for fightting for free and democratic Russia."
Navalny – anti-corruption campaigner and na di loudest opposition leader for Russia - die suddenly for jail on 16 February 2024 at di age of 47.
For 2020, dem poison am wit Novichok nerve agent. E go Germany for treatment, and dem arrest am for airport wen e return to Russia.

Wia dis foto come from, German Federal Foreign Office via Getty Images
Bifor Saturday announcement, Navalny wife Yulia Navalnaya don dey argue say dem kill her husband wit poison while e dey serve prison time for Arctic penal colony for 2024.
Last September, Navalnaya tok say analysis of smuggled biological samples wey two countries carry out for laboratories show say dem don "murder" her husband.
She no give details on di poison wey dem allegedly use or di samples or di analysis - but she challenge di two laboratories to publish dia results.
Reacting to di announcement, Navalnaya tok: "I dey certain from di first day say dem don poison my husband, but now we get proof.
I dey grateful to di European states for di meticulous work wey dem carry out ova two years and for uncovering di truth," she add.
Di Kremlin neva comment on di allegations.
Russian President Vladimir Putin, wey dey avoid to call Navalny name while e dey alive, a month afta e die say wen pesin die "na always sad event".
At di time wey him die, Navalny don dey for jail for three years on trumped-up charges and dem don recently transfer am to Arctic Circle penal colony.
According to Russian accounts, di 47-year-old take small walk for im Siberian penal colony, e tok say e no dey feel well, den collapse and e no wake up again.










