Why US Embassy ask citizens to stay away from military facilities for Abuja

Foto of Abuja city gate and logo of US embassy

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 4 mins

Di United States Mission for Nigeria don give security alert to Americans wey dey. di capital of di West African kontri.

For statement wey dem release, di US Consulate draw ear for American citizens to avoid any travel to military goment facilities wey no too dey important.

Di United States Consulate say dem bring out dis security warning sake of increased global security concerns.

Dem also all dia embassy staff including dia families make dem no visit military sites or oda goment places for di Federal Capital Territory, Abuja unless na official work wey dey required.

"Due to increased security concerns wey dey arise from current global developments, U.S. Mission Nigeria dey informsU.S. citizens say all U.S. Embassy employees and dia families dey banned from non-official travel to a Nigerian military site or oda goment venue for Abuja at dis time." dem tok inside statement.

Di US Consulate also advise dia citizens wey dey currently live or travel through Nigeria to shine dia eyes well-well and remain vigilant.

Di security alert also tell dem di kain actions dem suppose take incase of any kasala.

Di actions wey dem go take na for dem to dey alert for public places, wit particular attention to location and venues wia Westerners, expatriates, and government officials frequent.

  • Avoid large gatherings and make dem consider to reduce unnecessary travel.
  • Make dem avoid predictable routines wey pipo already sabi about dem.
  • Make dem familiarize diasef wit emergency exits wen dem enta buildings and make dem also review dia personal security plans.

Despite di kasala wey dey happun across di world, Nigeria dey also face internal security problems wey don lead to several deaths in di last three months.

Recently one suicide bomber bin dey for near one Abuja Military base.

No be di first time international organizations dey bring our security warnings like dis for dia citizens.

'Nigeria still dey safe' - Minister of Information

Nigeria goment don react to di security advisory wey di US Consulate give dia citizens wey ban dem and dia families from non-official travel to military sites or oda goment facilities for di Nigeria capital, Abuja.

For statement, Nigeria goment say dem recognise and respects di right of foreign missions, including di U.S. Embassy, to issue travel advisories to dia citizens.

Nigeria goment say e dey important for dem to state categorically say Abuja dey safe for citizens, residents, and visitors.

"Nigeria security agencies dey work around di clock to ensure di continued safety and protection of all residents of di FCT and across di kontri.

Di current security architecture for Abuja no only dey proactive but e also record significant successes to detect, prevent, and neutralise threats."

Di Federal Goment add say dem understand say di U.S. advisory dey based on general global developments and e no reflect any imminent or specific threat within di FCT.

Di minister of information and National Orientation for di statement tell "all diplomatic missions, investors, development partners, and di general public say no cause for alarm."

As dem assure dia commitment to di safety of all residents and to maintain di reputation of Abuja as one of di most secure capitals for di world.