Protesters clash wit men wey carry weapon for Kenya ova di death of one blogger for police custody

One protester dey wear black face mask

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Albert Ojwang death for police custody dey cause tension for Kenya
    • Author, Anne Soy
    • Role, BBC News, Nairobi
  • Read am in 3 mins

Kenyan protesters don clash wit young men wey carry weapon - club - wey dey loyal to di government, for di centre of di capital, Nairobi.

Di demonstration dey hapun afta di death of blogger and teacher Albert Ojwang for police custody 10 days ago, dem dey demand for di sacking of di top police officer.

Police bin tok say Ojwang die of self-inflicted wounds, but dem retract di statement afta autopsy find say e likely die afta assault. Dem don arrest two policemen in connection wit di death.

Di protest comes as tension dey ahead of di first anniversary of di parliament demonstrators.

Earlier on Tuesday, violence hapun for di capital central business district wen groups of young men wey dey ride motorbikes, armed wit whips and clubs, attack protesters.

Videos show say di men bin dey like dem dey work side-by-side wit police, wey fire teargas to try and scata di demonstrations.

Reuters news agency don report say dia staff see di body of one man on di street wit head wound. Police tok-tok pesin for Kenya don tok say im dey unaware of di death.

Dem don deploy officers across key parts of di city, in an attempt to block protesters from accessing major intersections and government buildings.

Deputy police chief Eliud Lagat don step aside as investigation into Ojwang death continue.

But activists want make dem comot am from office becos na im complaint against di blogger lead to di young man arrest. Dem accuse di 31-year-old of defaming Oga Lagat on social media.

Di situation for Nairobi remain tense. Dem don shut down most business in di city centre and na only few pipo dey di streets.

Last year, young Kenyans lead protest, against one unpopular finance bill wey dem wan use to introduce new taxes. Dem forcefully enta di parliament on 25 June and force di government make dem drop di controversial proposals.

No tax measures dis year, but activists dey plan to build up momentum for wetin dem dey call "total shutdown" of business next Wednesday.

Additional reporting by Akisa Wandera