Dem hit and assault Kenyan blogger to death - autopsy reveal

Wia dis foto come from, EPA
- Author, Akisa Wandera & Basillioh Rukanga
- Role, BBC News, Nairobi
- Read am in 6 mins
Post-mortem don reveal say dem hit di Kenyan blogger wey die for police custody for head and di cause of im death go likely be from beating.
Dis report different from police claims wey say Albert Ojwang "sustain head injuries afta e hit im head against one cell wall".
Im death don spark widespread outrage for Kenya, as rights groups dey demand say make authorities hold police accountable.
Dem detain 31-year-old Ojwang afta one complaint by di deputy police chief, wey dem accuse say e tarnish im name on social media.
"Di cause of death dey very clear; head injury, neck compression and oda injuries spread all ova di body and dat dey point towards assault," state pathologist Bernard Midia tok.
Police neva comment on di findings.
Wetin di autopsy show
Police arrest Oga Ojwang for Homa Bay, one town for western Kenya, on Friday, sake of one post e make on X wey allegedly dey critical of Deputy Inspector General of Police Eliud Lagat.
Dem later transfer am go di capital, Nairobi, wey dey ova 350km (220 miles) from wia dem arrest am and book am for di Central Police Station on Saturday.
Police tok say dem later find am unconscious for im cell wit injuries e do on himself (self-inflicted injuries).
But one autopsy, wey five pathologists carry out and dem release unanimous report, reveal say Ojwang get severe head injuries and e suffer neck compression and multiple soft tissue trauma.
Dr Midia, wey lead di team of pathologists, tok say Mr Ojwang no hit himself on di wall, as police bin tok for statement on Sunday.
E say if Ojwang bin wunjure imsef, di pattern of injuries for dey different, and dem go see frontal bleeding on im head.
"But di bleeds wey we see on di scalp… for di skin of di head no dey togeda, including on di face, sides of di head and for di back of di head," Dr Midia tok for one press conference.
"Multiple soft tissue injuries also dey wey spread all ova di body, including for di head, neck, upper limbs plus di trunk and lower limbs... these na injuries from attack," e add.
Di injuries dey consistent wit "external assault" and signs of struggle also dey, according to pathologists.
Why Police arrest Albert Ojwang wey later die for custody

Wia dis foto come from, X
On Monday, 9 June, plenty activists bin stage protest outside one mortuary for Kenya capital, Nairobi.
Di protest na sake of one 31-year-old blogger wey die for police custody.
Albert Omondi Ojwang death dey spark outrage for Kenya.
Police arrest Ojwang afta di deputy police chief file complain against am, e accuse am of tarnishing im name on social media.
For one initial statement, police tok say Ojwang "bin sustain head injuries afta e hit im head against one cell wall" for custody.
However, Ojwang family lawyer, Julius Juma, tok say di body show signs of severe physical trauma, wey include swelling on di head, nose and ears.
Oga Juma also say im see bruises on Ojwang shoulders and hands - injuries wey e say no dey consistent wit one single impact against a wall.
Kenya Independent Policing Oversight Authority (IPOA) don launch inquiry into im death.
Protesters hold placards and dey chant "Stop killing us", dem protest for Nairobi City mortuary, wia dem keep Ojwang body.
Di crowd later march go di Central Police Station wia dem hold Ojwang bifor di time of im death.
Dis article contain content wey Facebook provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Facebook cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Facebook post
How Kenyan blogger die for police custody
Police arrest Ojwang for Homa Bay, one town for western Kenya, on Friday, 7 June, sake of one post e put on X wey allegedly criticise di Deputy Inspector General of Police, Eliud Lagat.
Dem later transfer am go Nairobi, wey dey ova over 350 km (220 miles) from wia dem arrest am and book am into Central Police Station on Saturday, 8 June.
According to oga Kanja, dem arrest Mr Ojwang afta oga Lagat file one complain say e dey "tarnish" im name.
"Na on dat basis dem carry out investigations," Kanja tok for one press conference.
For dia response to heavy public pressure, Kanja announce say dem don take actions against senior officers for Nairobi Central Police Station.
Police tok-tok pesin Michael Muchiri, tell BBC say dis one mean say di officers no go fit perform dia duties, and dem go receive half of dia salaries, pending di outcome of di investigation by IPOA.
Speaking at a press conference, Inspector General Kanja tok say di police go give di investigators all "necessary support" to solve di case.
Dem find Ojwang unconscious during one routine inspection of di cells and dem "rush am go hospital, wia dem pronounce am dead on arrival", police tok.
Di director of Amnesty International Kenya branch, Irungu Houghton, tell BBC say Ojwang death dey "very suspicious".
Oga Houghton tok say e dey "quite shocking" say dem no book Ojwang for di local police station afta dem detain am, but instead dem carry am on long journey.
On Sunday, 8 June, e call on independent investigators to secure wetin e describe as "di crime scene" for di police station for Nairobi.
Ojwang death for detention dey come at a time of rising concern on top how dem dey treat some goment critics.
Last week, software developer Rose Njeri, wey create one tool to help pipo oppose one goment finance bill, dem sama am charge wit accuse say she violate cybercrime law. She deny di charge.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Kenyans react to di death of di blogger
Faith Odhiambo, president of di Law Society of Kenya (LSK), tok say di autopsy report clearly show say dem "torture" and "brutally murder" Ojwang for police custody.
"We go continue to put pressure until dem hold every single officer wey get hand for dis mata personally liable. We no go accept more excuses," Ms Odhiambo tok.
Veteran opposition leader Raila Odinga condemn Oga Ojwang "horrifying" death, e say e don add to long list of "young and defenceless Kenyans wey dem take dia lives too soon, in brutal and senseless circumstances, for di hands of di police".
Inspector-General of Police Douglas Kanja earlier suspend plenty officers wey bin dey on duty at di time of Oga Ojwang death.
But human rights groups don demand more action, dem say di death of di blogger na attempt to silence di digital community through intimidation and fear.
Kenya Independent Policing Oversight Authority (IPOA) don open investigation into im death










