Ugandan activist allege say dem rape am during detention for Tanzania

Agather Atuhaire display bruises and scars for her hand afta her release from detention by Tanzanian authorities, outside one hospital in Kampala - 23 May 2025.

Wia dis foto come from, AFP/Getty Images

Wetin we call dis foto, Tanzanian authorities neva comment on Agather Atuhaire allegations
    • Author, Cecilia Macaulay, Wycliffe Muia & Swaibu Ibrahim
    • Role, BBC News, London, Nairobi & Kampala
  • Read am in 4 mins

Warning: Dis tori get details of sexual assault

One Ugandan activist wey dem arrest and hold for days in Tanzania and dem later find at di border between di two kontris don tell BBC say dem rape am for detention.

Expanding on wetin she bin tok earlier, her rights group tok say she show "indications of torture", Agather Atuhaire allege say pipo wey wear plain clothes "blindfold" her, afta which dem hit her, "violently" strip and sexually assault her.

Dem hold Atuhaire wia she no fit tok for Tanzania alongside fellow Kenyan activist Boniface Mwangi, wey dem later find on Thursday for di border.

Di Tanzanian authorities neva comment.

"Di pain dey too much," Atuhaire tok, as she show BBC one mark from wia dem handcuff am.

She add say she dey "scream so hard" dem get to cover her mouth.

Atuhaire tell BBC about her alleged rape in graphic detail.

She tok say she also hear screams from Mwangi, and pipo wey dey hold am threaten to circumcise am.

Di pair bin dey go Tanzania to show solidarity wit opposition leader Tundu Lissu, im appear for court on Monday afta dem charge am wit treason

Mwangi recount im alleged experience for one post on X: "Dem torture us, and ask us to strip naked and to go baff. We no fit waka and dem tell us to crawl and go wash off di blood."

Despite say dem allow dem into di kontri, Mwangi and Atuhaire no dey permitted to attend di hearing and dem arrest dem.

On Monday, President Samia Suluhu Hassan warn say she no go allow activists from neighbouring kontri to "meddle" in her kontri affairs and cause "chaos".

Dem find Atuhaire wia dem abandon her for di border on Thursday night afta she bin dey custody since Monday, Agora Centre for Research, one Uganda-based rights group, post on X.

Uganda high commissioner to Tanzania Fred Mwesigye tok say Atuhaire don "safely return home" and "her family don warmly receive am".

Mwangi, wey dem bin find on di roadside for northern Tanzania near di Kenyan border, tok say im dey hear as Atuhaire dey "groan in pain" wen dem hold dem togeda on Tuesday.

"Any attempt to speak to each oda during di night dem torture, and kick and insult us. Dem remove us from di torture location in different vehicles," Mwangi tok.

E tok say pipo wey hold dem dey get dia orders from di "state security" official, dem direct dem to give di activists "Tanzanian treatment".

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Boniface Mwangi (for centre in white T-shirt and shorts, im wife Njeri (in black dress) and odas wey seat on top chair inside one room

Wia dis foto come from, KNCHR/X

Wetin we call dis foto, Kenya state-funded rights body share one foto of Mwangi (centre) on Thursday

Mwangi disappearance bin spark widespread concern across Kenya, wit im family, civil society and human rights group wey organise protests and demand for im release.

On Wednesday, di Kenyan goment formally protest against im detention, accusing di Tanzanian authorities of denying consular access despite repeated requests.

Earlier on Thursday, Kenya foreign affairs ministry issue one statement wia dem tok say dem no get access to di activist.

Regional rights groups don call for investigation into di alleged mistreatment of di activists by di Tanzanian authorities and urge all East African kontris make dem uphold rights treaties.

Additional reporting by Basillioh Rukanga in Nairobi