Scientists propose new ways to comot malaria from mosquitoes body

Two tiny mosquitoes native to Africa dey for pesin thumb

Wia dis foto come from, Getty Images

    • Author, James Gallagher and Philippa Roxby
    • Role, Health and science correspondent
  • Read am in 3 mins

US researchers tok say make dem dey give Mosquitoes malaria drugs to clear dia infection so dem no go fit spread di disease.

Malaria parasites, fit kill nearly 600,000 pipo yearly, mostly children, na female mosquitoes dey spread am wen dem suck blood.

Current effort aim to kill mosquitoes wit insecticide rather dan curing dem of malaria.

But one team for Harvard University don find pair of drugs wey fit successfully comot malaria from di insects body wen dem absorb am through dia legs. Coating bed nets in di drug cocktail na di long-term aim.

Sleeping under bed na one of di most successful ways of preventing malaria as di main malaria-spreading mosquitoes dey hunt for night.

Also, dem dey recommend vaccines to protect children wey dey live in high-risk malaria areas.

Nets are na both physical barrier and also contain insecticides wey fit kill mosquitoes wey dey land on dem.

But mosquitoes don become resistant to insecticide in many kontris so di chemicals no longer kill di insects as effectively as dem bin dey do.

"We neva really try to directly kill parasites in di mosquito bifor dis, becos we bin just dey kill di mosquito," Dr Alexandra Probst, Harvard researcher tok.

However, she say di approach no longer dey effective.

Di researchers analyse malaria DNA to find possible weak spot while e dey infect mosquitoes.

Dem use potential drugs and narrowed am down to shortlist of 22. Dem test wen female mosquitoes give blood-meal contaminated wit malaria.

Inside dia article in Nature, di scientists describe two highly effective drugs wey dey kill 100% of di parasites.

Dem dey test di drugs were on material similar to bed nets.

"Even if dat mosquito survives contact wit di bed net, di parasites within go die and so e no fit transmit malaria,"Dr Probst tok.

"I tink say dis na really exciting approach, becos na totally new way of targeting mosquitoes demselves."

She tok say di malaria parasite dey less likely to become resistant to di drugs as dem get billions of dem for each infected person, but less dan five in each mosquito.

Di effect of di drugs go last for one year on di nets, potentially making am di cheap and long-lasting alternative to insecticide, di researchers tok.

Dis approach don dey proven in di laboratory. Dem don already plan di next stage for Ethiopia to see if di anti-malarial bed nets dey effective in di real world.

E go take at least six years bifor all di studies go dey complete to know if dis approach go work.

But di vision na to get bed nets treated wit both anti-malaria drugs and insecticide so if one approach no work, den di oda go work.