Israel carry out strike on senior Hamas leaders for Qatari capital

Screengrab of footage showing di building for Doha in di aftermath of strike

Wia dis foto come from, X/BBC Verify

Read am in 4 mins

Israel don launch strike on Hamas leaders for Qatar on Tuesday, dia officials tok.

Di Israel Defence Forces (IDF) tok say e carry out di targeted attack on Hamas officials, shortly afta di militant group claim responsibility for di attack wey kill six pipo for Jerusalem bus stop.

One senior Israeli official tell Israeli media say di Hamas members wey dey targeted include Khalil al-Hayya, di chief negotiator and exiled Gaza leader, and Zaher Jabarin, di exiled West Bank leader.

"We dey await di results of di strike. Consensus dey among di political and security leadership," di official tok.

E neva clear how dem take carry out di attack but di IDF don confam inside one statement say na dem carry out di strike.

"Di IDF and ISA conduct one precise strike targeting di senior leadership of di Hamas terrorist organization," IDF tok.

"For years, dis members of di Hamas leadership don lead di terrorist organization operations, directly responsible for di brutal October 7 massacre, and dem don dey plan and manage di war against di State of Israel."

Israel tok say dem take measure to ensure say civillains dey safe bifor dem carry out di strike.

"Bifor di strike, we take measures in order to mitigate harm to civilians, including di use of precise munitions and additional intelligence," IDF tok.

"Di IDF and ISA go continue to operate wit determination in order to defeat di Hamas terrorist organization responsible for di October 7 massacre."

Qatar na di acting mediator between Israel and Hamas and e don host negotiations between dem since October 2023.

E neva clear if pipo die for di attack but Hamas official tell BBC say di strike target di Hamas negotiating team for Qatar.

On Sunday, Hamas tok say e don welcome "some ideas" from di US about how to reach Gaza ceasefire agreement wey e receive through mediators.

Smoke rise afta several blasts for Doha in Qatar.

Wia dis foto come from, Reuters

Qatar tok say Israeli strike na 'blatant violation' of international laws

One tok-tok pesin for Qatar foreign ministry don condemn "in di strongest possible terms" di attack wey Israel don claim responsibility for.

Dr Majed Al Ansari tok say di strike hit one residential premises "wia some members of Hamas political bureau dey stay for in di Qatari capital, Doha".

E tok say di attack constitute "blatant violation" of international laws as well as "serious threat" to pipo wey dey for Qatar.

"Di State of Qatar strongly condemn dis attack, and vow say dem no go tolerate dis reckless Israeli behaviour and di continuous tampering wit di security of di region and any action aimed at dia security and sovereignty," di statement tok.

Countries, NGOs react to Israeli strike on Qatar

Iran Foreign Ministry tok-tok pesin Esmail Baghaei say di action na "blatant violation of international law" and "infringement upon di national sovereignty of Qatar and di Palestinian negotiators".

E must serve as "serious warning for di region and di international community," di foreign ministry tok-tok pesin tok.

Iran and Israel don dey hold ceasefire since late June.

White House confam say Israel notify Trump administration about di Israeli strike on Doha bifor e take place.

Di attack by Israel on Qatar, one major non-Nato ally for di US, immediately raise question about di level of US awareness and involvement, particularly di approximately 10,000 US military personnel wey dey stationed for di kontri.

UN Secretary General Antonio Guterres condemn "di violation of di sovereignty and territorial integrity of Qatar".

E tok say, im just learn of di strike on Qatar, e describe am as "kontri wey don dey play vey positive role to achieve ceasefire and release of all hostages".

"All parties must work to achieve permanent ceasefire, no be to destroy am," di UN chief tok.

Arab nations condemn Israeli strike on Qatari capital

Middle East kontris don condem di Israeli strike on Hamas officials for di Qatari capital, Doha.

Jordan condemn di Israeli strike for Qatar. Di kontri foreign ministry describe am as "dangerous and unacceptable provocative escalation".

Inside similar sentiment, Kuwait express "strong condemnation and denunciation" of di strike, emphasising dia "full support" for di measures wey Qatar go take in retaliation.

Abdullah bin Zayed, deputy prime minster of di UAE, don also strongly condemn di attack.

Di Sultan of Oman, inside one statement from Oman foreign ministry, describe di strike as "blatant breach of sovereignty".