Why Israeli military order 'all residents' of Gaza City to comot sharp-sharp

Wia dis foto come from, Reuters
Di Israeli military don give order to all di residents of Gaza City make dem "comot sharp-sharp", say dem dey plan to operate for di area wit "great force"
For social media post, IDF Arabic-language tok-tok pesin beg "di pipo wey dey for all di neighbourhoods" to relocate to humanitarian zone
Israel dey order as many as one million pipo to comot from di city - but di UN say nowhere for Gaza wey dem fit consider "safe", na wetin Wyre Davies write for Jerusalem.
E come afta Israel security cabinet bin approved plan to take control of di enclave most populous city last month - a move wey world leaders don condemn.
Di Israeli goment no dey allow international news organisations, including di BBC, into Gaza to report freely.
Why di urgent evacuation?

Wia dis foto come from, Reuters
Di Israeli Defense Force say dem 'go operate for Gaza City area wit great force'
Avichay Adraee say di evacuation order dey directed to "all residents of di city of Gaza and di pipo wey dey present for all di neighbourhoods, from di Old City and Tafah to di east and up to di sea to di west".
Im add say di military dey "determined to eliminate Hamas and dem go operate for di Gaza city area wit great force, as dem bin don operate for various parts of di Strip".
"For your safety, evacuate immediately via di Al-Rashid axis towards di humanitarian zone for Al-Mawasi," Adraee tok, im add say "to remain for di area dey extremely dangerous".
Israel dey, in effect, order as many as one million pipo to leave di biggest place wey dey made up of large cities and towns.
One urban area wey pipo wey don previously separate for cities or towns grow togeda and merge into single region.
Di area dey veri populated for di Gaza Strip for wetin, Israel say, na di "humanitarian safe zone" of al-Mawasi, further south.
Israel say dem go provide food and medical aid, but al-Mawasi and oda designated safe zones don dey repeatedly bombed during di war and di UN say nowhere for Gaza wey dem fit consider "safe".
Small hope still dey say di complex ceasefire proposals wey Donald Trump put forward fit bring Israeli and Hamas negotiators back to di table, but Israeli military activity wey dey inside and around Gaza City don intensify, including air strikes overnight.
Benjamin Netanyahu say more dan 50 buildings bin dey blown up by di Israeli Air Force in recent days and imm say na "only di beginning of di main, intensive operation" – a ground incursion into Gaza City.

Wia dis foto come from, Reuters
Reuters news agency also capture video footage wey show hundreds of leaflets wey dey float for di sky above Gaza City.
Di leaflets include map of di evacuation orders and di same message wey di Israel Defense Forces writing online - "evacuate sharp-sharp".
For dat order, wey di IDF Arabic-language tok-tok pesin give, e tell residents of di city make dem head towards di humanitarian zone for al-Mawasi.
Ahead of di strikes wey go hapun on Saturday for one high-rise tower block, Israel drop leaflets wey repeat calls for Palestinians to relocate to wetin dem call humanitarian zone for di south.
Meanwhile pipo still dey die of malnutrition, for di latest update, di Hamas-run health ministry says six more pipo don die for Gaza sake of malnutrition in di past 24 hours.
Dis bring di total number of deaths due to malnutrition to 399 wey include 140 children.








