Israel say dia plan no be to kill journalists as dem confam strike on Nasser Hospital area

Mariam Dagga na freelance journalist wey bin dey work wit di Associated Press bifor she die for di Israeli airstrike

Wia dis foto come from, AP

Read am in 4 mins

At least 20 pipo don die, including four journalists, inside Israeli airstrike for one hospital for di southern Gaza Strip

Reuters report say cameraman Hussam al-Masri, one of di journalists wey die for di strikes according to di officials, na contractor for dem. Photographer Hatem Khaled, wey also be Reuters contractor, wunjure, di officials tok.

Di Israeli military for statement say dem carry out strike for di area, adding say dem "regret any harm to uninvolved individuals and dem no dey journalists like dat."

You go remember say Israel defence minister bin don warn say dem go destroy Gaza City if Hamas no agree disarm and release all hostages.

Israel Katz comments dey come afta di Israeli cabinet approve plans for massive assault on Gaza City, despite widespread international and domestic opposition.

Dem kill several pipo for di first strike, and odas for di second wey happun as rescuers attend di scene, di Hamas-run Civil Defence tok.

Palestinian medics bring an injured man at Nasser Hospital in Khan Yunis, in the southern Gaza Strip, on August 25, 2025,

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

Di Foreign Press Association don call for "immediate explanation" from di Israeli military and Prime Minister office afta di death f fi tori pipo from different major international news outlets.

Di joinbodi tok for statement say, "dis na among di deadliest Israeli attacks for tori pipo wey dey work for international media since di Gaza war start".

Dem say di strike for Nasser Hospital for Khan Younis bin "come wit no warnnf" and hit di outside staircase of di hospital "wia tori pipo dey normally tanda wit dia cameras".

Di association wey dey support tori pipo around di world say "we dey call on Israel once and for all make dem stop dia targeting of tori pipo".

Di Israel Defense Forces say e "no dey target tori pipo" for dia ansa wey dem give to di attack on Monday.

On Monday 18 August, Hamas bin agree to one proposal by Qatari and Egyptian mediators for 60-day ceasefire, wey according to Qatar go see di release of half of di remaining hostages for Gaza.

But Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu apparently reject dis, and tok say e bin don give instruction for negotiations to begin for di release of all remaining hostages and an end to di war for Gaza on terms wey dey "acceptable to Israel".

Monday attack dey come two weeks afta six journalists wey include four from Al Jazeera, die for Israeli targeted attack near al-Shifa Hospital for Gaza City.

Di UN human rights office condemn di attack wey dem call am grave breach of international law.

Di Israel Defense Forces (IDF) say dem target Anas al-Sharif, popular Al Jazeera reporter, wey dem allege say e "serve as di head of terrorist cell for Hamas".

Di Committee to Protect Journalists (CPJ), leading body wey dey promote press freedom, say Israel don fail to provide evidence to back up dia allegations.

Dem don kill ova 190 tori pipo since di start of di Israel-Gaza war according to di CPJ and at least 180 of dem na Palestinians wey Israel kill.

Meanwhile, di United Kingdom foreign secretary say di deadly strike for di hospital leave am "horrified".

David Lammy write for X say, "civillians, healthcare workers and tori pipo must to dey protected. We need immediate ceasefire."

Di Israeli military say e carry out strike for di area of hospital. Hamas Civil Defence sha tok say plenti pipo bin die ofr di first strike for Nasser HospitL and odas dey for anoda strike wey happun as rescuers bin dey deal wit di first.

'Wetin we see I no go fit forget'

Liz Allcock for middle of tok-tok

Liz Allock wey be di oga of humanitarian protection for Medical Aid for Palestines bin dey Nasser Hospital for morning wen di strike happun.

She dey metres away from di explosion.

For interview wey she give di BBC, Allock tok say she bin go di hospital to visit patient wen she hear "very loud explosion, very close by."

She remember say in few seconds pipo start to dey enta di hospital wit blood and dist.

"Wetin we see na tins wey I no go eva forget. We don see plenti tins, for di year and half wey I don dey hear and in di almost two years since di kasala, and e just dey get worse."

She explain say di surgical unit bin dey full of patients wey dey wait surgery or for recovery from di immediate aftermath of surgery.

Allock say Nasser don alreadi dey overcrowded as Israel dey order clinics for di North and Gaza City to comot and now di hospital dey over stretched.