Nigeria presidency deny tori say President Bola Tinubu staff try to poison am

President Bola Tinubu

Wia dis foto come from, Nigeria Presidency

Read am in 3 mins

Di office of di President of Nigeria don deny tori wey bin dey fly around on top social media say one staff for di presidential kitchen bin wan poison President Bola Tinubu.

Bayo Onanuga di tok-tok pesin for President Tinubu post on im social media platforms say notin like dat hapun and say make pipo no pay attention to di rumour.

"No Aso Rock kitchen staff dey arrested. No Aso Rock kitchen staff bin attempt to poison President Tinubu. Please ignore dis fake news wey dem dey disseminate for dis video," Onanuga tok for im short statement on X.

So wia and how dis rumour start?

Ova di weekend, one video start to dey fly around on top social media and for di video, di narrator claim say police arrest one "presidential chef" on top accuse say e wan poison President Tinubu.

Di video claim say di incident bin require "intervention by one special police squad and trigger heightened security for di presidential environment".

E no dey clear wia di 90-second video come from, but e gada thousands of views and shares and reactions across di various social media platforms wia dem share am.

But even wit as Onanuga clarify say di video na fake news, some pipo still no believe am, as one pesin comment for di post say: "Dat na how you bin deny di news of coup against Tinubu but later e turn out to be true."

For October 2025, rumour bin spread say some members of di Nigeria armed forces bin wan remove President Tinubu from office via coup, but di presidency and di army release statement dat time to deny di reports.

Howeva, e later turn out say true-true some soldiers bin plan coup but di plan fail and all di officers wey dey involve bin dey arrested and dem dey face court martial now.

So far, no security agency for Nigeria don announce say dem make any arrest or start any investigation relating to any poisoning attempt on di president.

Dis no go be di first time rumour go spread about a possible poison attempt against a sitting president for Nigeria.

For July 1998, shortly afta di death of di Nigeria Head of State for dat time, speculations bin dey say e fit be say Abacha bin dey poisoned by im inner circle, but dat account no dey substantiated.

Official report about Abacha death tok say di former Head of State bin die of heart attack.

More recently, for Africa di family of di former President of Zambia, Edgar Lungu, bin deny di rumour wey tok say e die sake of poison attack.

Lungu - wey lead Zambia from 2015 to 2021 - bin die of one undisclosed illness for Pretoria South Africa, for June 2025, but one of im daughters allege say dem poison her papa.

However, di larger Lungu family, for one interview wit di BBC deny di allegation as di body of di former president still dey for Morgue for South Africa sake of di wahala betwin di Zambia authorities and di family.