Dem use gold casket bury Mexican drug lord 'El Mencho'

Wia dis foto come from, Reuters
- Author, Vanessa Buschschlüter
- Role, Latin America digital editor
- Read am in 4 mins
Di Mexican drug lord Nemesio Oseguera Cervantes alias "El Mencho", family use golden casket take bury am on Monday.
Di 59 year old founder of di notorious Jalisco New Generation Cartel (CJNG) bin dey as di most wanted man for di kontri while di US bin offer $15m (£11.2m) for informate wey go lead to im arrest.
Im death don ginger revenge kasala wia cartel members burn motor dem and block roads acrss Mexican states.
Members of di National Guard bin full ground so dem go fit guard against new kasala for di colourful burial wey happun near Guadalajara for Jalisco state wey be di cartel stronghold.
Pipo see dem as dem dey carry tributes of big flowers enta di funeral home bifor di ceremony.
Dis flower arrangement include one wey resemble rooster to reference how e take like cockfighting.

Wia dis foto come from, Reuters

Wia dis foto come from, Francisco Guasco/EPA/Shutterstock
According to AFP news agency, dem need five lorries to carry all di tributes go di cemetary. Most of dem bin dey sent witout names attached.
Di funeral procession bin dey followed by band wey dey play ranchero music plus narcocorridos, wey be songs to praise drug lords.
Di traditional song El Muchacho Alegre (Di Cheerful Boy) bin dey play as Oseguera gold coloured coffin bin enta one chapel wey dey inside di cemetary grounds, according to local tori pipo.
Afta ceremony wey last of one hour, di mourners, many wey use mask hide face, follow di coffin as dem carry am go grave.
Mexican tori pipo point out say di plot no loud like oda drug dealers. As some of dem dey get big-big mausoleums for dia grave sites.

Wia dis foto come from, Ulises Ruiz/AFP via Getty Image
Under Oseguera leadership, di CJGN turn poweful criminal organisation wey spread from wia dem get stronghold for Jalisco enta oda Mexican states wia dem deal in drug making and trafficking.
Oseguera killing by Mexican special forces bin dey seen as victory for President Claudia Sheinbaum govment. Dis na bicos dem don come under pressure by US President Donald Trump say make dem do more to fight drug trafficking.
But fear dey say dis hole wey di powerful cartel leader leave so fit ginger serious kasala in di short term. Dis na bicos di different factions for inside di criminal group wey dey estimated to get tens of thousands of members fit start to fight for control.








