In maps: Areas Israel, US and Iran don strike across di Middle East

Wia dis foto come from, Reuters
As di war enta di fourth day, Israel say dem don attack one "leadership compound" for Tehran.
Israel say dem drop "plenty weapons" on di Presidential Office and di Supreme National Security Council for Tehran on Tuesday, just hours afta dem launch fresh attacks for Lebanon and expand dia ground operation for di kontri to target Hezbollah sites.
Hezbollah bin fire rockets and drones into Israel afta di bombing raid wey kill Iran Supreme Leader Ali Khamenei.
For Riyadh, Saudi officials tok say overnight, two Iranian drones hit di US embassy and e cause some limited damage.
Israeli strikes don also continue for Iran.
About 787 pipo don die for Iran since US and Israel launch strikes for di kontri on Saturday, Iran Red Crescent Society tok.
Meanwhile, US-based Human Rights Activists for Iran (HRANA) report say 742 civilians don die wey include 176 children.
Six American military personnel don die since di conflict start, according to di US Central Command.
US President Donald Trump don warn since say combat operations go continue wit "full force" until dem achieve all of Washington objective.

Where Israel and US don strike?
Di Israeli military bin announce extensive joint strikes wit di US ova di weekend and destroy dia air defences for western and central Iran.
Verified videos from di Iranian capital Tehran show big smoke wey dey rise above di city on Saturday.
BBC Verify get di satellite image wey dem take dat morning, and e show significant damage to part of di compound of Leadership House, di office of Ayatollah Khamenei.
Israel military tok say di strikes on Tehran bin target gatherings of senior political and security figures.
BBC Verify so far don confam visual evidence of strikes on 13 different locations for Tehran, wit 12 oda towns and cities across Iran wey dem also hit.

At least 153 people die for one girls' school for Minab for di south of di kontri wen three missiles hit am on Saturday, Iranian state media report.
BBC neva fit independently verify dis.
Military sites dey targeted for Kermanshah and Tabriz, and Iranian naval facilities for Konarak and Bandar Abbas for di south of di kontri.
US President Donald Trump say US forces don sink 10 Iranian naval ships and "largely destroy" dia naval headquarters.
Israel don expand operations into Lebanon, wia dem dey target Hezbollah, di militant group wey for long dey back Iran.
On Tuesday night, Israeli officials tok say dia troops don enta Lebanon and don begin seize "strategic areas" in order to prevent attacks on Israeli border communities.
Di move bin come afta Israel announce on Monday say dem dey carry out strikes for both Iran and Lebanon afta Hezbollah launch missiles overnight on Haifa.
Israel air assault bin target Hezbollah stronghold for di southern suburbs of Beirut and areas wey dey close to di city airport, plus sites for southern Lebanon.
Blasts for di city bin continue into Tuesday morning.
Where Iran don strike?

Iran don retaliate wit strikes on Israel and US bases for di region, and dem don chop blames for air attacks on Gulf states.
On Tuesday night, Saudi officials tok say two drones hit di US Embassy for Riyadh, and e cause some minor damage and spark small fire.
Reports dey of new Iranian strikes on one major gas plant for Qatar, wia di Ministry of Defense later tok say dem shoot down two Iranian aircraft, seven missiles and five drones.
For di United Arab Emirates (UAE), wey include di tourist destinations of Dubai and Abu Dhabi, three pipo die and several pipo dey injured, di kontri defence ministry tok on Sunday.
Kuwait health ministry report one death on Sunday. Officials say ballistic missiles wey dem successfully intercept bin target di The Ali Al-Salem airbase.
Di kontri military crash three US fighter jets on Monday for inside "one friendly fire incident", US Central Command tok. All six crew dey safe and okay, dem tok.
For neighbouring Iraq, dem crash three drones on Monday ova Irbil airport wey host US-led coalition troops.
Bahrain National Communication Centre on Saturday tok say di service centre of di US Navy Fifth Fleet bin dey "subjected to missile attack".
Also for Bahrain, one verified clip, wey dem feem from one moving vehicle, show di moment wen one missile strike. Explosion follow immediately wey send fragments and wetin remain into di air.
On Sunday evening, one drone strike di US naval base and e cause major fire, one official tell BBC, but no reports of casualties.
Iranian attacks for Bahrain injure four pipo, di official add.

For Saudi Arabia, one fire for di Ras Tanura refinery - wey di kontri state oil company, Aramco dey operate - dey under control afta dem intercept two drones wey dey targeted to am, officials tok.
Officials for Jordan, wey dey di border of Israel, say dia armed forces shoot down ballistic missiles wey target dia territory.
Oman state news agency on Sunday report say two drones bin target Duqm commercial port, and one worker injure.
Wetin hapun for Cyprus?

One Iranian drone crash into RAF Akrotiri for midnight (22:00 GMT Sunday), Cypriot President Nikos Christodoulides announce.
No casualties dey reported and di base sustain "minimal damage", but UK Ministry of Defence say dem don move family members.
On Monday, one Cypriot govment tok-tok pesin say dem intercept two more drones wey bin dey head towards RAF Akrotiri.
How di conflict dey affect di global economy?

Global oil and gas prices rise sharply on Monday, as producers, insurers and shipping firms dey affected by di war and di closure of di Strait of Hormuz.
Di cost of European gas bin rise ova 30% afta di world largest producer of liquefied natural gas (LNG), Qatar Energy, tok say dem dey pause production.
Qatar dey supply around a fifth of global LNG supplies.
Di past two days don see several reports of attacks on shipping for di Strait.








