Wetin countries dey do for dia stranded citizens inside US-Israel war wit Iran

Wia dis foto come from, Getty Images
Govments across di world don begin take measures to ensure di safety of dia citizens for di Middle East as di impact of di US-Israel war wit Iran continue to spread and intensify.
While some nations like Ghana, UK, US, don begin process to remove dia citizens from di conflict zones, some nations don already evacuate dia citizens, and odas like di Nigerian govment don ask dia kontri pipo to follow safety advisory as dem go continue to monitor di situation.
Na on Saturday, 28 February US and Israel bin launch massive attacks on Iran, wey target Iran missile infrastructure, military sites and leadership.
Iran Supreme Leader, Ayatollah Ali Khamenei, wey bin lead Iran since 1989, die during di first wave of strikes.
Iran bin respond by launching attacks on Israel and US-allied states for di Gulf, wey don extend to non-military targets, including civilian sites and energy facilities.
Also, sake of di war, thousands of airlines and flights wey dey fly to and from di region don cancel or suspend dia services, and airspaces remain closed.
However, dis na how some govments dey respond to dia citizens wey hook for di region.

Wia dis foto come from, EPA/Shutterstock
United Kingdom
End of Di one wey oda users dey read well well
UK govment go on Wednesday fly some British nationals wey dey stranded for di Middle East back home as Iranian missile and drone attacks against di Gulf continue to ground flights.
One chartered plane go leave Muscat International Airport for Oman at 23:00 local time (19:00 GMT), as dem prioritize seat for di most vulnerable.
More dan 130,000 Britons don register dia interest for help to leave di region since war between di US-Israel war wit Iran start on Saturday.
British officials say dem dey look for more ways to respond to wetin dem describe as di biggest disruption to travel since di Covid-19 pandemic.
United States
US dey send charter flights to evacuate Americans from di United Arab Emirates, Jordan and Saudi Arabia as di US-Israeli war wit Iran continue to ginger.
US State Department bin tok on Monday say make Americans "depart now" from Bahrain, Egypt, Iran, Iraq, Israel, di occupied West Bank and Gaza, Jordan, Kuwait, Lebanon, Oman, Qatar, Saudi Arabia, Syria, United Arab Emirates and Yemen sake of "serious safety risks".
Di State Department say dem dey work actively to secure military aircraft and charter flights for Americans wey wan leave di Middle East.
"We dey in direct contact wit nearly 3,000 Americans abroad," Dylan Johnson of di State Department tok on X, and urge citizens to call di department line for assistance.
For anoda statement, di department say 9,000 US citizens don already successfully return home from di region. Di department tok say dem dey help pipo book flights from countries wia commercial air travel still be option.
Between 500,000 and one million US nationals dey estimated to dey live for di Middle East.
US govment ask dia citizens to check "di latest security updates" wit nearby embassies and consulates, and dem release hotlines dem fit reach if dem need help to comot di region.
Irish
One Emirates flight go comot Dubai for Dublin on Wednesday evening, di Irish Department of Foreign Affairs tok.
E go carry passengers wey dem cancel dia flights for di weekend.
Irish Foreign Affairs Minister Helen McEntee tok say di Emirates flight na "positive development" and say di department dey "in close touch wit di airline".
France
On Tuesday, France tok say dem ready to fly back dia citizens wey dey at risk for di Middle East di most.
French Foreign Minister Jean-Noël Barrot tell di kontri BFM TV broadcaster say dem fit do dis by both commercial and military flights.
One French govment official tok say about 400,000 French nationals dey affected by di situation.
Australia
Foreign Minister Penny Wong say Australia dey follow airlines tok to help di 115,000 Australians wey dey stranded for di Middle East. Wong add say evacuations go dey difficult while much of di region airspace remain closed.
Nigeria
Nigeria Ministry of Foreign Affairs wen di conflict start release advisory for dia citizens for di region wey ask dem to limit movement, obey security and safety directives wey local authorities issue and maintain vigilance.
Govment say dem go continue to monitor di situation and ensure say no Nigerian life dey for danger.
Ghana
Ghana Minister of Foreign Affairs Samuel Ablakwa, say currently dem dey help some Ghanaians wey dey stranded escape across certain strategic border crossings.
E add say dem don put togeda a reliable database of all Ghanaians for di affected countries wey include dos wey bin dey on short visits plus dos wey bin dey transit.
Germany
Di German govment tok say na di tourism industry dey responsible for bringing home most of roughly 30,000 Germans wey dey stranded for di region and add say military repatriation na last resort.
Italy
One first charter flight wey carry 127 Italian citizens wey bin dey stranded for Oman, or wey move go there from Dubai, bin land for Rome Fiumicino airport late on Monday.
Passengers wey land Rome tok say na di Italian embassy help wit dia evacuation.
Spain
Spain don begin evacuate dia citizens from di Middle East, Foreign Minister Jose Manuel Albares bin tok on Tuesday.










