Two Euracare doctors chop suspension ova death of Chimamanda Adichie son

Wia dis foto come from, John Lamparski/Getty Images
Euracare Hospital don react to tori say di Medical and Dental Practitioners Investigation Panel for Nigeria don suspend several doctors for dia hospital.
For inside one statement, di hospital confam say 13 doctors dey affected by di suspension.
However, two of dem be members of dia clinical staff and dem dey connected to di ongoing proceedings wey relate to di death of Master Nkanu Nnamdi Esege, di 21-month-old son of novelist Chimamanda Ngozi Adichie, wey die for di hospital for January.
"Both doctors don in dia respective careers, contribute meaningfully to di delivery of quality healthcare to Nigerian patients for standard wey dey comparable to wetin dey obtainable for di world leading medical facilities," di statement tok.
E no dey clear who be di oda affected doctors.
However, Euracare say dem dey fully committed to cooperating wit regulatory and judicial authorities as investigations continue.
Di hospital also raise concerns about aspects of di investigative process. Dem say, "certain established processes and protocols no dey followed in di manner required," and express deep concern say "e be like say matters covered by patient and institutional confidentiality dey disclosed outside di appropriate channels". Dem describe dis as a "serious breach wey no fit go unaddressed."
Na for 7 January na im Nigerian writer Chimamanda Adichie and her family announce di death of her son Nkanu Nnamdi, one of di twin boys wey di renowned author bin announce dia birth for 2025.
According to one statement from Omawumi Ogbe who be di tok-tok pesin for Chimamanda, little Nnamdi die on Wednesday, 7 January, "after a brief illness".
Adichie and her family bin accuse Euracare of negligence, and allege say medics deny Nkanu of oxygen and dem administer excess sedation, wey dem say lead to cardiac arrest.
Di hospital express dia "deepest sympathies" ova di child death but deny any wrongdoing.
Three days later, Lagos State govment order investigation into di circumstances wey surround di death of Nigerian writer Chimamanda Ngozi Adichie pikin.
Special Adviser to di Govnor on Health, Dr Kemi Ogunyemi say in line wit dis directive, HEFAMAA don since commence investigation and don visit di facility involved as part of di ongoing inquiry. Di agency go conduct comprehensive review of all allegations and reports wey relate to di incident.
"Di investigation go examine di allegations raised, including compliance wit established clinical protocols, professional conduct, patient safety standards, and di roles and responsibilities of all parties wey dey involved. Findings of di investigation go dey public as soon as di process dey concluded, for di interest of transparency and public accountability," di statement tok.
For one leaked detailed personal account, Adichie say her son for dey alive if no be di incident for Euracare Hospital on 6 January.
Adichie tok-tok pesin Omawumi Ogbe tell BBC say di personal account bin shared by Adichie within closed circle of family and friends, and add say e no dey intended for public release.
"While we dey saddened say such deeply personal account of grief and trauma bin dey leaked, di details there in highlight di devastating clinical failures di family now dey forced to confront. We hope say di substance of dat message, wey detail di gross medical negligence wey lead to dis tragedy, remain di central focus even as we look forward to di truth and accountability."
Euracare Hospital come respond to di allegations wey Chimamanda Ngozi Adichie sama dem ova di death of her son.
For statement wey dem send to BBC, Euracare say some report about di incident dey inaccurate as dem sympathise wit di family.
Di hospital describe diasef as reputable centre for complex medical care, and say dem get internationally trained professionals.
"Di patient, wey bin dey critically ill, bin dey referred to our facility for specific diagnostic procedures after e receive treatment for a period of time at two paediatric centres.
"Upon arrival, our medical team immediately provide care in line wit established clinical protocols and internationally accepted medical standards, including di administration of sedation wia clinically indicated," di statement tok.
Euracare say in di course of Nkanu care, dem work collaboratively wit external medical teams as recommended by im family and ensure say all necessary clinical support bin dey provided.
"Despite dis concerted efforts, di patient sadly pass away less dan 24 hours afta e present for our facility."

Wia dis foto come from, Instagram/Chimamanda Adichie
Chimamanda Adichie for February 2025 reveal to one tori pesin for UK say she and her husband, Dr Ivara Esege, get twin boys wey dem born through surrogacy.
Surrogacy na method of having pikin wey be say one woman, di surrogate, go carry di baby and born am on behalf of anoda pesin or couple, who go now be di legitimate parent or parents of di baby.
Later for May 2025, Chimamnda tok for anoda interview wit Nigerian journalist Chude, say she no get any regrets say she use surrogacy take born her twins.
"I want make more women no dey feel ashamed of talking about reaching motherhood tru non-traditional means," she explain.
"Wetin I bin tok about having my twins through surrogacy na true bicos e get some tins wey you simply no fit hide. You no fit hide di existence of two perfect human beings."
Adichie na also outspoken feminist and she don give speeches around di world to call for more equality for women.
Adichie bin born her first pikin, a daughter, in 2016.
Adichie bin lose both her parents in di space of just few months.
Her papa James Nwoye Adichie, a professor of statistics, bin die suddenly from complications of kidney failure during di Covid pandemic period for 2020, while her mama who be di first female registrar for di University of Nigeria, Nsukka, also die several months later, in March 2021.









