Multiple award-winning author Chimamanda Adichie lose one of her twin sons

Wia dis foto come from, Luka Dakskobler/SOPA Images/LightRocket via Getty Images
Nigerian writer Chimamanda Adichie and her family don announce di death of her son Nkanu Nnamdi, one of di twin boys wey di renowned author bin announce dia birth in 2025.
According to one statement from Omawumi Ogbe who be di tok-tok pesin for Chimamanda, little Nnamdi die on Wednesday, 7 January, "after a brief illness".
"Di family dey devastated by dis ogbonge loss, and we dey beg make dia privacy dey respected during dis incredibly difficult time," di statement tok.
Chimamanda Adichie bin shock di world in February 2025 wen she reveal to one tori pesin for UK say she and her husband, Dr Ivara Esege, get twin boys wey dem born through surrogacy.
Surrogacy na method of having pikin wey be say one woman, di surrogate, go carry di baby and born am on behalf of anoda pesin or couple, who go now be di legitimate parent or parents of di baby.
Usually, di pikin dey come from di sperm and eggs of di legal parents, only say doctors go transfer am into di womb of di surrogate afta fertilisation.
Later in May 2025, Chimamnda tok for anoda interview wit Nigerian journalist Chude, say she no get any regrets say she use surrogacy take born her twins.
"I want make more women no dey feel ashamed of talking about reaching motherhood tru non-traditional means," she explain.
"Wetin I bin tok about having my twins tru surrogacy na true bicos e get some tins wey you simply no fit hide. You no fit hide di existence of two perfect human beings."
Adichie na also outspoken feminist and she don give speeches around di world to call for more equality for women.
Dis go be anoda tragedy to hit di author afta she lose both her parents in di space of just few months.
Her papa James Nwoye Adichie, a professor of statistics, bin die suddenly from complications of kidney failure during di Covid pandemic period in 2020, while her mama who be di first female registrar for di University of Nigeria, Nsukka, also die several months later, in March 2021.









