'Iran try to kill Trump' - US military claim

Preside Donald Trup for di White House as e dey monitor Military Operations

Wia dis foto come from, The White House via X Account/Anadolu via Getty Images

Read am in 3 mins

Di US military don announce say dem bin kpai one Iranian official wey bin dey as di head one unit wey allegedly try kpai US President Donald Trump.

For tok-tok wit tori pipo inside di Pentagon, na im di US Secretary of Defense, Pete Hegseth bin download dis informate.

E tok say, "Iran bin try kill President Trump. Na President Trump bin laugh last".

Hegseth add say on Tuesday, di US "hunted down and killed" di "leader of di unit wey attempt to kpai President Trump".

But e no tok who di pesin be.

Howeva, for 2024, di US govment bin carry charges nack one Afghan national wey dey link to one alleged Iran plot to kpai Trump bifor e enta office afta im win di election dat year.

Di Department of Justice bin allege say Farhad Shakeri, wey be 51 year old, bin dey given di work to "provide plan" to kill Trump.

Di US govment bin tok dat time say Shakeri bin dey believed to dey in Iran.

For one criminal complaint wey dem file for one Manhattan court, prosecutors bin allege say one official from Iran Revolutionary Guard na im guide Shakeri for September to plan di plan to surveil and kill Trump.

Wetin US claim say na di plot to kill Trump for 2024

US Attorney General Merrick Garland bin reveal say, "di Justice Department don charge asset of di Iranian regime wey dem bin give am work to direct one network of criminal associates to further Iran assasination plots against im targets wey include President-elect Donald Trump".

At di time, Iran foreign ministry tok-tok pesin, Esmaeil Baghaei tok say dat kain accusations of attempts to kpai US presidents don dey made bifor, wey Iran don deny and dem later prove say na lie.

For 2024, Trump don face two seperate alleged assassination attempts. For July, one guman bin scratch di president ear afta e shoot am for one Pennsylvania rally.

Den, for September, dem arrest one man wey bin point one gun to Trump wey golf on im course for West Palm Beach.

Last month, for February 2026, US Secret Service bin kpai one 21 year old Austin T Martin afta e bin carry shotgun and fuel enta inside di secure perimeter of Trump Mar-a-Lago residence.

Di indictment claim say oga Shakeri bin dey asked to come up wit one plan to kill Trump in seven days.

According to prosecutors, Shakeri tell law enforment say en bin no inent to give plan to kpai Trump inside dos seven days so di Iranian Revolutionary Guard officials match breaks on di plan.

Prosecitor also tok say Oga Shakeri bin reveal say di Iranian govment tell am sat e go easy pass to kpai Trump afta di election bicos dem bin no tink say e go win.

Prosecutors bin describe am say na Afghan national wey enta US wen e be pikin but dem deport afta di man bin spend 14 years inside prison for armed robbery