Police confam attack for Gwoza wey kill and kidnap pipo but silent on tori about ambush of sojas

Wia dis foto come from, JORIS BOLOMEY/AFP via Getty Images
Police for Nigeria don confam to di BBC say jaguda pipo attack Ngoshe community for Borno State, northeastern Nigeria wia dem kill and abduct pipo but dem no confam di exact number of casualties.
Police tok-tok pesin for Borno State, Nahum Daso Kenneth, tell di BBC on Friday say na on Wednesday night di attack happun.
"I fit confam say one unfortunate incident and, due to di efforts of security personnel, we bin dey able to repel di insurgents," im tok. Im add say search and rescue operation dey go on for di community.
Local media dey report say suspected militants abduct more dan 100 women and children during di attack.
Di reports say di attackers bin also target one nearby military base and one internally displaced persons camp for di area, wia dem kill many sojas and civilians, including di village chief, cleric and some community elders.
Di BBC don contact di Nigerian military for comment.
Umaru Yakubu Kirawa, wey be local journalist for Borno, tell di BBC say residents don confam say di jaguda pipo kill plenti pipo and dem abduct hundreds of odas.
Im tok say residents bin tell am say dem dey "call for [security] reinforcement. Dem dey fast; some of dem bin don break dia fast, and unfortunately some of dem no fit break dia fast" before di armed men attack dem.
Ngoshe na community wey muslim plenti well-well, and tori be say di attack happun for night wen many pipo bin dey break dia Ramadan fast.
Kirawa say di village dey inside-inside and residents bin comot from dia before sake insecurity for Borno State, but "dis na di first attack for dere afta dia resettlement by di govment".
For many years, Borno State na di centre of insurgency for Nigeria, dem dey experience repeated attacks by Boko Haram and fighters from Islamic State West Africa Province (Iswap).
Boko Haram become popular for 2014 afta dem bin abduct more dan 200 schoolgirls from Chibok for di state.
Politicians react to di attack for Gwoza
Nigerian lawmaker Mohammed Ali Ndume, di lawmarker wey dey represent Borno South Senatorial District wia Gwoza local govment dey under, describe di attack as "veri devastating".
E tok say apart from 2009 and 2014 wen dem bin get dis kain of attack since dem e neva happun like dis.
"We no know di number of casualties as of now and dem don occupy di place since Tuesday and Wednesday and na until Thursday wey di Nigerian Army ground troops move in, na di intervention by di Nigeria Airforce we reduce di threats on ground. Di situation dey terrible and nobody go fit tell you wetin dey actually happun for dia, di exact number of casualties because nobody go fit tell you. Wetin we know be say di Nigeria Arny don enta di place and dem dey pursue di insurgents(jaguda pipo). Im add.
Former Vice President of Nigeria, Atiku Abubakar don also chook mouth for di Gwoza attack.
For im post for im verified X handle, di multiple time presidential aspirant say di attack 'dey deeply troubling"
Im add say na di "apparent indifference of di Federal Govment to dis incident and to many similar attacks" wey dey happun for dia eyes dey pain pass.
According to Atiku violence and killings don dey spread across di kontri to di extent wey e be like say both govment and society don grow to di extent wey bloodshed from dis assaults no dey shake dem again.
"E dey unfortunate say e be like say di current federal govment dey lose dia grip on di fight against terrorism and violent attacks. Instead, e be like say dem dey more focused to unleash intense pressure against political opponents and enabling self-serving ethnic militia groups.
Im tell victims and dia families sorry sake of di frequent attacks wey dey happun for di kontri.









