Na suspected suicide bomber die for Abuja explosion - Nema

Wia dis foto come from, Nigeria Defence
Di National Emergency Management Agency (Nema) say di explosion wey happun on Monday afternoon for Abuja na as a result of IED wey go off on a suspected suicide bomber.
For one statement wey dem post for dia verified X account, Nema say di incident happen in front of Abacha Barracks - wey im formal name na 'Mogadishu Cantonement - along di Abuja-Keffi Road.
But for dia statement, Nema say information wey dem gather "reveal say, one suicide bomber bin attempt to sneak into di Barrack but e meet im waterloo as di IED bin explode for im bodi as e dey try to negotiate entry".
"Di suicide bomber die instantly and one passerby injure. Di EOD unit of di Nigeria Police Force carry di pesin wey injure to National Hospital and take over di scene for further investigation," di statement tok.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Di Nigerian Army bin confam di explosion on Monday but dem no give details about wetin cause am or weda weda anybodi die or wunjure.
"Explosion at bus stop opposite Mogadishu Cantonment Abuja situation under control. Details later," na wetin dem post.
Also, di Nigerian police tok say dem receive "distress report regarding explosion" and dem dey investigate di incident wey happun near di Mogadishu military cantonment.
Di cantonment na majorly members of di Airforce and Navy dey live for dia.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
History of bomb blasts in Abuja

Wia dis foto come from, AFP
Abuja, di capital city of Nigeria dey relatively secure since di boko haram insurgency blow up for 2010.
However, di first incident of bombing for Abuja no be boko haram do am, but na by di Movement for di Emancipation of di Niger Delta (Mend).
Dat bomb attack bin happen on October 1, 2010, close to di eagle square arena for Abuja, as pipo dey gather for di 50th Independence celebration of Nigeria.
About 12 pipo die for dat attack and many odas bin injure. And later in March of 2018, one Federal High Court for Abuja sentence Charles Okah - leader of Mend -and im second Obi Nwabueze to life for prison sake of di attack.
Di first case of suicide bombing for Abuja na di attack for di United Nations Building for di Central Business District, on 27 August, 2011, wia one suicide bomber bin drive car full of explosives into di United Nations building.
At least 18 pipo die for dat attack and Boko Haram claim responsibility.
On Christmas Day of di same 2011, 35 pipo die for anoda bomb attack for St Theresa Catholic Church for Madala, one satellite town for di border between di Federal Capital Territory and Niger State.
Di oda bomb attacks include di one for di Nyanya bus park on April 14, 2014, wey kill about 88 pipo; plus another one for anoda nearby garage on May 1, 2014 wia at least 19 pipo die.
Den, in June 2014, anoda bomb attack happen for one popular plaza for Wuse 2 area of Abuja.
Also, on October 3, 2015, two bomb attacks happen at di same time for two locations for Abuja; one in Kuje and di oda one in Nyanya again. Both Nyanya and Kuje na satellite towns for di outskirt of Abuja city centre.
Di attacks kill 18 pipo in total and injure 41 odas.
More recently, two pipo die for one explosion wey happen for one primary school for di Bwari area of Abuja for January dis year.
Police later confirm say na three men from Katsina wey visit di owner of di Islamic school bin carry di bomb enta.
"Two of di men die for di explosion as dem dey tamper wit di improvised explosive device (IED), for di school Veranda, while di third man and one female trader bin get serious injuries," police tok.










