Five times wey area pipo kill security officers for Nigeria

Nigerian Army

Wia dis foto come from, Getty Images

If you take away di killings by terrorist groups like Boko Haram, Biafra separatists and jaguda pipo wey dey steal from pipo, one of di killings wey annoy Nigerian security forces pass na di one wey pipo do dia members.

E get situations wia di security forces go go town sake of say kasala burst dia, but di area pipo go kill dem anyhow, sometimes sef e dey lead to serious revenge from di security forces.

For different times for Nigeria history, security forces, especially military or police, go attack dis kain towns out of revenge witout minding who be adult and who be pikin, or who be man or woman.

Most of di time, youths wey dia blood dey hot fit commit dis kain atrocity against di security agents den run go hide leave dia family members, wey go eventually suffer for di crime wey dem commit.

Now di Nigerian Army dey mourn 17 of dia brodas wey youth gang for Delta State kill on Thursday 14 March.

Di killing go make am five times wey area pipo dey kill security forces agents for Nigeria since 1999 wey di kontri return to civilian rule.

Dis na list of five towns wia community members kill security officers.

Odi for Bayelsa State

For November 1999, one group of youths near Odi town for Kolokuma/Opokuma Local Goment Area of Bayelsa State for Niger Delta region, massacre 12 Nigerian soldiers and policemen wey bin go separate fight for di town.

For dia revenge attack, soldiers enta di town lauch di kain attack wey clear dia doubt. Dem destroy plus burn down evritin for dat village, notin remain.

Authorities and human right groups for dat time bin report say dem kill about 900 civilians.

However, di military authorities deny di accuse. Dem say dem no try to destroy di town wia dem commit di massacre.

For 2013, one high court for Abuja order Nigeria goment to pay Odi pipo 37.6 billion naira in compensation for pipo wey dem kill.

But, di Goodluck Jonatan goment wey dey power dat time pay 15 billion naira, afta dem settle di mata wit di leaders of di town.

Nigeria army and police dey do joint peacekeeping

Wia dis foto come from, Getty Images

Alakyo for Nassarawa State

For 2013, one man wey dem susupect say na witch, Baba Alaky, for Alakyo village of Nassarawa State kill more dan 55 policemen and more dan 10 security officers.

Tori be say, some youths wey be di witch followers, wey dem call 'Ombatse' bin don dey attack security agents wey bin dey try stop di witchcraft activities of Baba Alakyo, wey dey destroy pipo life for di community.

Confam informate say di members of di secret group waylay di security officers wey dem send from Abuja, collect dia weapons, massacre dem before dem burn dia bodi.

One senior police officer wey bin witness wetin happun tell tori pipo say "dis na di first wey I dey see pipo kill security officers in cold blood since I don dey work for 30 years for security".

Dura-Du for Plateau State

Dura na one village under Jos South Local Goment Area for Plateau State.

Soldiers bin blame youths for di village for di killing of one Army general wey dem bin dey call General Idris Alkali wey bin dey miss wit im car for 2018.

Di General bin dey travel from Abuja to Bauchi on di 30 of August 2018.

Dem later find di deadi bodi of di general for one pond.

Di general bin dey travel go Bauchi wen im clash wit some youth wey bin dey do i-no-go-gree for di killing of 11 of dia pipo, by some pipo wey come attack dem.

Zaki-Biam for Benue State

Di youths of Zaki-Biam town for Benue State ambush army come kill 19 of dem for October 2021.

Di goment bin send dem to go make peace for one fight fight between Tiv and Jukun tribes wey bin dey fight each oda for Zaki-Biam Local Goment Area for Benue and Logo for Taraba State.

Di killing of di soldiers make di army attack di town of Zaki-Biam for wetin dem call di perpetrators of di crime.

Human Rights Watch say di Nigeria army bin kill hundreds of pipo plus burn di environment. Di soldiers deny di accuse.

Okuama for Delta State

Seventeen soldiers wey youths kill for Okuama

Wia dis foto come from, NIGERIAN ARMY/X

Okuama na di latest for di killing of security officers wey don occur for di kontri.

Dis na town for Delta State for Niger Delta region, wia youth gang attack soldiers wey bin dey try calm riot for di area, come kill 17 on 14 March 2024.

According to reports, di youths kill di soldiers in humiliating manner, wia dem rip out dia hearts afta killing dem.

Nigeria President, Bola Ahmed Tinubu give order make dem find di pipo wey commit di massacre anywia wey dem dey.

Tori be say say Okuama pipo don run comot from dia town sake of fear of wetin fit happun.

Wetin dis attacks mean?

One security expert and head of Beacon Consulting, wey be security consulting company, Malam Kabiru Adamu give some reasons wey fit dey behind dis kain attacks on security forces:

  • Security forces and di pipo wey dem dey provide di security for no get good relationship, maybe becos dem no know di region or di culture or religion of di pipo for di area wey dem dey protect.
  • One side among di pipo wey dey fight dey accuse di security forces of supporting di oda side as dem dey try bring peace.
  • Sometimes, if di security agents refuse to give support or weapons to one side, dat side fit see dem as enemy wey dem suppose fight.
  • Attacks on security agents show say plenty weapons dey di hands of civilians becos wen pipo carry weapon, e dey make dem feel like say dem dey equal to any security officer.

Di solution?

Malam Kabiru Adamu say both di goment, security forces plus di whole community get hand to make sure say di killing of security forces, wey be di backbone of any kontri security, must end.

Im also list some steps to take:

Anyone wey dem find guilty of killing security agent gatz collect punishment so dat anybodi wey wey wan reason dis kain tin for future no go fit do am.

  • Di national security system gatz change.
  • Goment gatz provide security forces wit di necessary equipment.
  • Security forces gatz gada informate before dem go for any operations.
  • Dem gatz put di love of di security forces for di hearts of di kontri pipo so dem go sabi how important dem dey to dia lives and to di whole kontri.
  • You gatz always know which security officer be di right one for di situation - for example, na police officer abi na soldier be di right officer. "E dey important to check and see, no be evri kasala wey burst dem dey carry go meet soldier or policeman." Oga Kabiru tok.

Nigeria don lose plenty security agents inside 20 years sake of fight fight wey di kontri dey face.

Informate from security experts show how Nigeria don lose more dan 2000 security officers inside di last 10 years.

One statistic for 2021 show say Nigeria get less dan 500,000 security forces wey sabi pipo say dey too small for kontri wey get more dan two million pipo.