Ghana 69th Independence: Mahama wan file motion to UN to declare slavery crime against humanity

Wia dis foto come from, GHANA PRESIDENCY
Ghana President John Mahama say di kontri go later dis month, file one motion to di United Nations (UN) to declare slavery as crime against humanity.
Di president during di kontri 69th independence anniversary celebration say Ghana don come a long way from wen Dr Kwame Nkrumah declare independence from di British colonial masters.
"We dey work wit partners across Africa and di diaspora to seek historical justice," President Mahama tok.
Im also add say "we go submit motion to di United Nations to declare slavery and transatlantic slave trade as di greatest crime against humanity."
"Di motion go represent di justice and restitution wey be long overdue."
Im tok say Ghana wey be di first sub-Saharan kontri to gain independence, go once again lead di call "for dignity and restoration".
Ghana bin serve as slave trade headquarters from di 15th - 19th century wen di Europeans enta di kontri to carry di citizens away to build dia own kontris.
Di portuguese, Dutch and British bin collect di kontri resources and manpower to develop dia own kontris wey dem lerf Ghana and Africa poor.
For di 1960s, Ghana first president Dr Kwame Nkrumah and oda pipo now begin to find way to set Ghana free from di colonial masters.
Na so 6 March 1957, Nkrumah declare independence for Ghana wey oda Africa kontris also begin to learn say dem too fit get dia independence from di hand of di colonial masters.

Meanwhile di president don call for unity among di citizens for development to achieve di dream of di kontris founder and first president - Dr Kwame Nkrumah and di odas afta him.
President Mahama also tok say di govment go create jobs for di youth and ensure di proper management of di economy.
Dis be di second time di presidency don organize small Independence Day parade for di seat of govment to cut cost.
Young school children show culture, dance, poetry while di military and oda security agencies display for di programme wey prime minister for Saint Kitts and Nevis, Terrance Drew bin attend.
Ghana ex-president John Agyekum Kufour and Nana Akufo-Addo togeda wit di chief justice, speaker of parliament, govment officials and oda big pipo attend di anniversary parade.
Di theme for di celebration be 'building prosperity, restoring hope.'

Wia dis foto come from, SAWER JOHN AMONOR
Ghana go turn 70 years in 2027
On top social media many Ghanaians decide to wear dia jerseys and oda traditional costume wey dem take pictures to celebrate di day.
Meanwhile, Ghana traders don arrive for Zambia for di fugu exhibition; dis dey follow di trending fugu craze afta some Zambians bin troll president Mahama say im dey wear blouse.
Di traditional smock (fugu) wey dem carry hand and hard cotton to weave be traditional outfit wey kings, queens and warriors bin dey wear for di past – but now citizens dey fit wear am for social occasions.
Govment even declare evri Wednesday as 'Fugu Day' for pipo to wear di kontri smock to work and oda places.
Dis, according to di tourism ministry, go help to further "preserve, promote and celebrate Ghana rich cultural heritage".
Di ministry for one statement wey di sector minister Abla Dzifa Gomashie sign, add say pipo fit wear di smock (aka fugu and batakari) "for dia different forms."
Beyond di cultural heritage, "di initiative go create economic benefit wey e go empower local weavers, designers, artisans and traders across di value chain".
Dis dey happun days afta some pipo for Zambia troll Ghana President John Mahama wen e wear di smock for im three-day state visit to Zambia.

Wia dis foto come from, SAWER JOHN AMONOR
Later, Zambia president say e go order more smocks from Ghana to share for im cabinet.
Zambia also remove tax from import of smocks from Ghana as di fugu continue to get global attention.
Di kontri foreign affairs minister Samuel Okudzeto Ablakwa bin dey lead di exhibition drive from 6 -8 March 2026 togeda wit di Ghana export promotion authority.
Dem go also showcase traditional Ghana textile, fashion and food.
Di exhibition go boost economic diplomacy, tourism and cultural ties under di umbrella of Pan-Africanism.









