Laurent Mbanda of Rwanda emerge new leader of Global Anglican Church body, Gafcon

Di Most Revd Dr Laurent Mbanda
Wetin we call dis foto, Dr Mbanda na di head of di Anglican Church in Rwanda, and dem elect am for one closed door gathering of di Gafcon Primates Council on Wednesday night.
Read am in 3 mins

Di Most Revd Laurent Mbanda of Rwanda don emerge as di new leader of di Global Fellowship of Confessing Anglicans (Gafcon), one conservative group from di Anglican Communion who no longer dey recognise di Archbishop of Canterbury as dia leader.

Dem go dey address di new leader as 'Chairman of di Global Anglican Communion' - first among equals.

Mbanda na currently di Primate of di Anglican Church for Rwanda and dem elect am for one closed door - conclave-like gathering - of di Gafcon Primates Council on Wednesday night.

Dis development don bring di Anglican Church – di third largest christian denomination – closer to a split dan ever, just less dan three weeks bifor Dame Sarah Mullally go dey inaugurated as di Archbishop of Canterbury.

Di Archbishop of Canterbury and di Church of England neva react to dis new announcement.

New leader dey speak wit people behind am during di Gafcon meeting for Abuja to elect new leader

Di election na one of di major events for di ongoing Gafcon 26 conference for Abuja Nigeria, wey get in attendance hundreds of delegates of conservative Anglicans from across di world including North America, Australia, and Africa.

Representatives from di Anglican Church of England also attend di conference wey, according to Justin Murff, na Venerable Canon wey also serves as di G26 Press Secretary.

Gafcon say dem no be "splinter or rebel group" and maintain say dem "represent di majority of practicing Anglicans globally".

Di group maintain say dem no entirely dey against di idea of woman being di Archbishop of Canterbury, but ,rather dem accuse di Church hierarchy of England say dem introduce "strange teachings" wey no dey in line wit di Bible into di Anglican faith.

Chief of dis teachings na di blessing of same sex couples and ordaining pesins of same sex relationships as priests and even bishops.

During di opening service for di conference on Wednesday, one of di speakers say Gafcon don reject one brand of Christianity wey choose to say "Listen Lord, your children dey tok" instead of humble saying "Speak Lord, your servant dey listen".

Justin Murff, Gafcon 26 Press Secretary tell tori pipo during one press conference on Wednesday say, Gafcon no be breakaway faction from di global Anglican Communion, as e emphasize say na di Church in England don break away from di Communion.

E add say, di door still dey open for dem to "repent" and dey "reunited" wit di main body.

"Gafcon no be temporary pressure group or a reaction to a single controversy. Na a maturing fellowship wey get shared confessional identity, growing institutional structures, plus long-term commitment to di orthodox Anglican faith," Murff tok.