Full list of Ambassadors wey Tinubu post go 65 kontris

(L-R) Prof. Mahmood Yakubu, Reno Omokiri, Okezie Ikpeazu, Femi Fani-Kayode

Wia dis foto come from, INEC/RENO/IKPEAZU/FANI-KAYODE/FACEBOOK

Read am in 5 mins

President Bola Tinubu don approve di postings of 65 ambassadors-designate go various countries and di United Nations, for inside one move wey dey aimed at strengthening di kontri diplomatic presence abroad.

One tok-tok pesin to di President, Bayo Onanunyga announce di informate for statement on Thursday, 6 March.

Di list contain di names of 31 non-career ambassadors and 34 career diplomats, wey di President nominate last November.

For December, di Senate confam dem afta lawmakers screening and consideration of a report by di Committee on Foreign Affairs.

According to di Statement, Reno Omokri, one former presidential aide go serve as Nigeria ambassador to Mexico, Femi Fani-Kayode, one former aviation minister dey posted to Germany.

Also on di na di former chairman of di Independent National Electoral Commission, Mahmood Yakubu wey dey posted to Qatar.

Oga Onanuga tok say di Ministry of Foreign Affairs don already receive agrément from di United Kingdom for di High Commissioner-designate, Ambassador Aminu Dalhatu.

France also don also send agrément for Ambassador Ayo Oke.

E add say di ministry don send di nominations of di oda 62 designated envoys go all di countries concerned, plus one request say make dia agréments dey in line wit standard diplomatic practice.

Here na di full list of di ambassadors plus di countries dem dey assigned to;

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Postings of Non-career ambassadors/Hight Commissioners

1. Grace Bent – Lome, Togo

2. Ita Enang – South Africa

3. Ikpeazu Victor – Spain

4. Nkechi Linda Ufochukwu - Tel-Aviv, Israel

5. Mahmud Yakubu: Qatar

6. Paul Oga Adikwu - Di Vatican City Holy See

7. Vice Admiral Ibok-Ete Ekwe Ibas - The Philippines

8. Reno Omokri - Mexico City, Mexico

9. Abasi Ebraimah - Budapest, Hungary

10. Erelu Angela Adebayo - Portugal

11. Olumilua Oluwayimika Ayotunwa - Tokyo, Japan

12. Ugwuanyi Ifeanyi Lawrence - Athens, Greece

13. Chioma Priscilla Ohakim - Poland

14. Aminu Dalhatu - United Kingdom

15. Abdulrahman Bello Dambazau - Beijing, China

16. Tasiu Musa Maigari - Gambia

17. Olufemi Pedro - Australia

18. Muhammed Ubandoma Aliyu - Argentina

19. Lateef Kayode Are - United States of America

20. Joseph Sola Iji - Russia

21. Jimoh Ibrahim - UN Permanent Representative

22. Femi Fani Kayode - Germany

23. Prof. Isaak Folorunsho Adewole - Ottawa, Canada

24. Ajimobi Fatima Florence - Austria

25. Lola Akande - Sweden

26. Ayodele Oke - France

27. Yakubu Gambo - Saudi Arabia

28. Prof. Nora Ladi Daduut - Seoul, South Korea

29. Onueze Chukwujika Okocha - Dublin

30. Kulu Haruna Abubakar - Tunis, Tunisia

31. Jerry Samuel Manwe - Port of Spain, T&T

Posting of Career Diplomats

1. Nwabiola Ezenwa Chukuwemeka - Cote D'Ivoire

2. Besto Maimuna Ibrahim - Niger

3. Monica Okwuchukwu Enebechi - Sao Tome, STP

4. Mohammed Mahmud Lele - Algiers, Algeria

5. Endoni Synoph Paebi - Ouagadougou, Burkina Faso

6. Ahmed Mohammed Monguno - Cairo, Egypt

7. Jane Adams - Kingston, Jamaica

8. Clark-Omeru Alexandra - Lusaka, Zambia

9. Chima Geoggrey David - Bamako, Mali

10. Odumah Yvonne Ehinosen - Malabo, E/Guinea

11. Wasa Segun Ige - Beirut, Lebanon

12. Ruben Abimbola Samuel - Rome. Italy

13. Onaga Ogechukwu Kingsley - Maputo, Mozambique

14. Magaji Umar - Kinsasha, DR Congo

15. Muhammed Saidu Dahiru - New Delhi, India

16. Abdulssalam Habu Zayyad - Dakar, Senegal

17. Shehu Ilu Barde - Accra, Ghana

18. Aminu Nasir - Ethiopia

19. Abubakar Musa Musa - N'Djamena, Chad

20. Haidara Mohammed Idris - The Hague, Netherlands

21. Bako Adamu Umar - Rabat, Morocco

22. Sulu-Gambari Olatunji Ahmed - Malaysia

23. Romata Mohammed Omobolanle - Tanzania

24. Shaga John Shamah - Botswana

25. Salau Hamza Mohammed - Tehran, Iran

26. Ibrahim Danlami - Kenya

27. Ibrahim Adeola Mopelola - Cotonu, Benin

28. Ayeni Adebayo Emmanue - Brussels, Belgium

29. Akande Eahab Adekola - Berne, Switzerland

30. Arewa Esther - Windhoek, Namibia

31. Gergadi Joseph John - Libreville, Gabon

32. Luther Ogbomode Ayo-Kalata - Sierra-Leone

33. Danladi Yakubu Nyaku - Khartoum, Sudan

34. Bello Dogon-Daji Haliru - Bangkok, Thailand

President Tinubu don direct say make di Ministry of Foreign Affairs immediately start di induction programme for di ambassadors-designate and High Commissioners, e add.

Di ambassadorial appointments bin come afta govment critics lament say di absence of diplomats dey create gaps for Nigeria foreign representation.

Wetin be di difference between career and non-career ambassadors

Ambassadors na di highest-ranking diplomats wey dey represent dia kontri interest for outside dia kontri.

Di president na im dey appoint ambassadors to act as im representative for oda kontris. Dem dey always station dem for di embassy for any kontri dem send dem go.

Di ambassador work na to oversee all im kontri activities for any kontri e dey and to further strengthen foreign policy goals.

Di men and women wey dey serve as ambassadors fit be either "career" members of di Foreign Service or "non-career" political appointees.

Di career ambassadors dey trained for di work, dem go di school and don get plenty years of experience of working as diplomats.

Non-career ambassadors na political appointment. Di president fit appoint pesin as non-career ambassador maybe becos of im unique talent or expertise wey e go bring come di ambassadorial post no be because e get any training as ambassador.